Omo, the Falconets of Naija no dey carry last o! Dem just waka enter the WAFU B U20 Girls Cup like say na their backyard.
On Saturday, dem jam the Young Amazons of Benin 3–0, and e be like say na second win in a row for dem, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Dem dey show say this tournament na their playground.
Kareem Carry Falconets Go Another Level
Ramotalahi Kareem na the koko for this one. Girl waka enter the pitch like say na Messi dem dey copy. She knack two correct goals wey just make Benin shake for their boots.
First one come quick quick, finish calm, e just scatter Benin defence. Then, before 60 minutes reach, Kareem knack the second one, cold blooded finish like say na Champions League final.
Na Precious Oscar still show she own by adding third one for stoppage time. Omo, e be full package team job!
Coach Moses Aduku go dey jolly for this one because dem don collect full points two games running.
Falconets Dey Look Ghana, But Body Dey Tire
With two wins in the bag, Falconets don already dey the early favourite for this WAFU B U20 Girls Cup.
But the real wahala dey come now as dem go jam Ghana Black Princesses on Tuesday, November 11, 2025, by 10 a.m.
Problem be say this tournament dey tight. Two games for two days? Omo, na proper wahala for the girls body o.
Dem no get time to cool down, recover, or even shake leg small. If you no dey fit, you fit lose am for important clash.
Na young girls wey dey represent their country, and dem deserve small rest abeg, make dem perform better.




Be the first to comment on "Falconets Just Scatter Benin Young Amazons, Kareem Dey Fire Two Goals"