Na so Naija Super Falcons take land correct gbege for WAFCON 2024 as dem tear Zambia 5-0 anyhow on Friday, waka enter semi-final with style and pride.

Super Falcons dey celebrate dia 5-0 win against Zambia for WAFCON 2024

As the queens wey dey run African women football, dem no waste time at all – dem show who be boss from the first whistle, na weytin hitvibz dey yan be dat.

This win don set dem up for one hot semi-final wey go shele against either South Africa or Senegal.

Super Falcons No Waste Time, Na Dem Start Fire First

From the word “go”, na Nigeria dey run things. Just two minutes into the game, Osinachi Ohale nod one correct goal from Esther Okoronkwo free-kick – na clean finish.

Nigeria Super Falcons kuku show Zambia pepper for quarter-final clash

Later for 33rd minute, Okoronkwo do her own. She trap Rasheedat Ajibade’s cross with chest, then fire one hot left leg shot wey tear net – 2-0 sharp.

  Chinwendu Ihezuo Show Power from Bench, Score Third Goal as Pachuca No Dey Lose for Clausura

Zambia no fit hold ground as Falcons dey play dem like training. E no tey, water pass garri.

For second half, Chiwendu Ihezuo nack dem the third goal after she jones one defender and play pass keeper easy.

Dem never recover finish when Tosin Demehin jump pass everybody for 68th minute come nod another one from Okoronkwo – 4-0 just like that.

To finish the work, Ijamilusi run enter box for 90th minute come tap in Ajibade’s low cross – na so the coffin take close. 5-0 wey sweet everybody wey dey Nigeria side.

  Taiwo Lawal score again as Super Falcons babe save one point for Mazatlán for Liga MX Femenil

Super Falcons Eye 10th WAFCON Trophy After Zambia Showdown

Esther Okoronkwo don score again for WAFCON 2024 victory over Zambia

After this kind correct beating, e clear say Nigeria wan collect the WAFCON 2024 title again.

Next match go be against South Africa or Senegal, and dem sef go dey reason am wella because these Falcons dey high on confidence like say na fuel.

Wetin make this win mad gan na say five different players score – meaning say everybody dey ball, everybody dey hot. Falcons no just come to win – dem come to entertain.

  Super Eagles and Super Falcons Stars Abroad: Osimhen, Onuachu, Oshoala Deliver Mad Goala Dis Weekend
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 18, 2025 8:24 pm by Hitvibz Media