After Rafiu Durosinmi score for them, Viktoria Plzen fans don already dey celebrate say dem go carry three points for Europa League, but na so wahala burst for added time.
Even as Rafiu Durosinmi manage score em goal, na dem still chop painful last-minute breakfast for dia backyard, Hitvibz reports.
How e take happen? Oya, make we yarn!
Rafiu Durosinmi show class, but Viktoria Plzen miss golden chance
Rafiu Durosinmi enta dis match full of ginger, fresh from hin goal and assist wey help Viktoria Plzen nack Ferencvaros 3-0 for playoff.
E no even tey before Plzen think say dem don score first, but VAR show say na offside.
Before dem fit reset, Lazio don use chance take nack dem one, as Alessio Romagnoli blast ball enter net before halftime.
Second half never start well when Lukáš Kalvach deliver beta free-kick wey meet Durosinmi head, and na so di Nigerian forward balance am enter net.
E remain small make e score hin second goal, but Lazio keeper Ivan Provedel do wonders save.
Lazio come go dey play wahala ball, as Nicolo Rovella go collect red card for rough play. With Plzen pressing full ground, Samuel Gigot still collect another red, wey leave Lazio with nine men.
Na dia e for be, but Plzen no fit use dia extra men well.
98th-minute wahala as Lazio give Plzen hot breakfast
Plzen press tire, but dem no fit put another goal. Instead, na Lazio con shock dem for 98th minute.
Gustav Isaksen see chance, bend one sweet strike enter top corner, scatter Plzen dream for dia home ground.
Na only second time for 18 home Europa League matches wey Viktoria Plzen don lose, and Rafiu Durosinmi, wey coach comot for 85th minute, no fit do anything as hin side collapse for injury time.
Now, dem must go Rome go fight to still get hope for Europa League. E no go easy, but na dem sabi wetin dem go do.
Like this post?
We’d be delighted to hear from you. Please leave a comment in the box below!
Last Updated on March 7, 2025 1:35 am by Hitvibz Media



[…] Rafiu Durosinmi scatter net, wahala burst as Viktoria Plzen chop last-minute breakfast for Europa […]