Naija boy Nathan Tella carry engine for body on Saturday as he give one sweet assist to help Bayer Leverkusen wire their rivals, FC Köln, 2-1 for their own backyard.
The correct moment happen for 52nd minute when Tella set the ball give Patrik Schick to score the goal wey win the match, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Nathan Tella give assist wey help Bayer Leverkusen win for derby
This win confirm say Tella na baba, as the 26-year-old winger don get three assists for 16 Bundesliga matches for the Black and Reds this season.
After Tella don finish his work, coach change am for Eliesse Ben Seghir for 72nd minute. This win make Leverkusen stand gidigba for fifth position with 55 points after 31 games.
Na Schick clinical finishing make the difference for the 2-1 win, and this one don push Die Werkself enter the Bundesliga top five.
Even though dem win, Leverkusen struggle small for start because body dey pain dem after the cup match wey dem play for midweek.
Cologne try their best for beginning but goalkeeper Janis Blaswich and the goalpost no gree for dem, especially as Said El Mala miss one clear chance.
Leverkusen come punish dem for their wastefulness just before half-time. Referee blow penalty against Eric Martel because he touch ball with hand, and Schick no waste time to score the penalty.
As second half start, Schick score another one as he nak Nathan Tella cross enter net for far post. This one na his sixth goal for five league matches.
Cologne no gree fold arm; dem score one goal through Luca Waldschmidt after Leverkusen defense fail to clear El Mala move.
Tella impact ne em help Leverkusen maintain hope for top-five
The stadium come catch fire as Cologne fans dey shout, but Edmond Tapsoba do wonders as he clear ball for goal-line to make sure say Leverkusen carry the three points go house.
Even though this one na the first time Coach René Wagner dey taste defeat, Cologne still far from relegation zone with five points.
For Leverkusen, this na their fifth time wey dem no lose for RheinEnergieStadion, and e don show say their eye still dey European football.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on April 25, 2026 9:14 pm by Hitvibz Media



Stay connected