Esther Okoronkwo don start the new season with correct ginger. Na the first match be this, but she don already carry Player of the Match award after she score one goal and give one assist to help AFC Toronto win for away.

Esther Okoronkwo scores winning goal for AFC Toronto

The Super Falcons star show her quality as she give her first assist before she open her goal account for matchday one of Canada Northern Super League, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Esther Okoronkwo shine with goal and assist as Toronto pull comeback win

Okoronkwo set up the ball for the equalizer and later wire the winning goal as AFC Toronto come from 2-1 down to beat Vancouver Rise 3-2 for Swangard Stadium.

The Nigerian international show say she still get the fire as she return for her second season. She play for 84 minutes before Kaila Novak enter for her.

After that first season wey sweet well-well, the second season of the Northern Super League start with rematch between the two teams wey play final last year.

  Zambia Captain Banda Yan Strong Tori Give Super Falcons: "Na for Field We Go Talk"

Last season, the two teams jam five times—Toronto win two, lose two, and draw one. Now, dem don start from where dem stop with another better win.

Esther Okoronkwo celebrates AFC Toronto comeback win

The interesting part be say the 29-year-old Nigerian striker don get four goal contributions against this same team—two goals and two assists.

This Saturday morning match na real film as Toronto use sense take pass Vancouver for the game wey get five goals.

Toronto first score for inside eight minutes when Zoe Burns finish one clean move wey Sarah Stratigakis start.

  Osinachi Ohale knack late winner as Pachuca survive the comeback wey León try pull

Okoronkwo continue her “no-mercy” form for Northern Super League opener

But Vancouver no gree—Camila Reyes equalise eight minutes later, and Latifah Abdu score another one five minutes before half-time to make am 2-1.

When second half start, Toronto double their hustle. Stratigakis show face again, but this time na her name enter scoresheet for the 61st minute after she collect assist from Esther Okoronkwo.

As Toronto body don pepper, Esther Okoronkwo finish the work 11 minutes later. She fire the winning goal wey seal the game after beta performance for second half.

Esther Okoronkwo assist and goal performance Toronto

The match get plenty drama and sharp finishing, but Toronto na dem get the final say.

Last season, Okoronkwo record no be for here. She finish the league with 11 goals and eight assists, making total of 27 goal contributions for 29 matches.

  Toni Payne Burst Net, Help Everton Win as Jennifer Echegini Na Stoppage Time Hero for PSG

Right now, she dey on mission to break her own record—and she don start early.

No forget say she just sign new contract wey go keep her for the club reach 2027.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on April 25, 2026 7:00 am by Hitvibz Media