Super Falcons star Joy Omewa don continue to dey make her new club, BK Häcken, happy as she score late winning goal wey help the Swedish side beat Växjö DFF 2-1 for away match on Friday evening.

Joy Omewa Goal Against Växjö DFF seals a 2-1 Damallsvenskan victory

As the match dey 1-1 and both teams dey fight to carry the three points, the Nigerian star show say she get wetin e take as she score for 89th minute to give her team important 2-1 victory, na weytin Hitvibz dey yan be dat.

Joy Omewa Goal Against Växjö DFF Seal Important Victory

Last time Omewa score, na brace she collect as she help Häcken ladies scatter IK Uppsala Fotboll 9-0 for ground.

  Asisat Oshoala reach 20 goal contributions as Al Nassr give Al Hilal heavy beating like thief

That match also mark her first home start for the Swedish club, and she use am show say she mean business.

The 23-year-old get her third start of the season against Växjö, and she no waste the opportunity to make her presence felt.

With this latest goal, Omewa don score for three of her last five matches. Since she join Häcken during summer, she don score four goals for the club.

Joy Omewa Goal Against Växjö DFF Change the Game

Häcken take the lead for 26th minute after Alice Broman put the ball for her own net. The visitors hold on to that slim advantage as both teams enter half-time.

  Joy Omewa don complete shocking move go Swedish side Häcken after she comot from Nottingham Forest

But Växjö no gree give up without fight. Eight minutes after the hour mark, Thelma Persson join body with Elin Nilsson to help the hosts level the score.

As everybody don dey think say the two teams go share the points, Omewa come out like correct match winner.

The Nigerian forward find the back of the net for 89th minute, seal the 2-1 victory and make sure say Häcken carry all three points go house.

The win also mean say Omewa and her teammates don win three matches back-to-back since Juventus beat them for the UEFA Women’s Champions League.

With their confidence don rise again, the Black and Yellow go now focus on their next Champions League match as dem dey look for their first win for the competition.

  Uchenna Kanu fire second hat-trick for Cruz Azul as Olamide Adugbe, Joy Duru carry Žalgiris go reach promised land

Dem don lose to Inter Milan for their opening match, so dem go need to step up their game if dem wan turn things around.

Last Updated on October 23, 2026 9:28 pm by Hitvibz Media