See ehn, our Super Falcons number one keeper, Chiamaka Nnadozie, never even warm chair for England finish, but she don already dey scatter internet with her cruise.
The babe wey just waka commot from Paris FC go sign for Brighton, come dey yarn say this their preseason training no be here o, na weytin hitvibz dey yan be dat.
If na football banter, dem go call am “pressing like Guardiola team wey dey 90+10 still dey hunt ball.”
Chiamaka Nnadozie vs Brighton Preseason
At 24 years, the Rivers pikin wey don carry Super Falcons since 2018 no be small keeper o. Na Africa number one she be. She don catch net for Super Falcons 55 times – pressure na her middle name.
But this Brighton wahala training don make even iron lady dey find joke. She drop one cruise for online:
“If I survive Brighton preseason, na straight to Thanksgiving, no delay.”
Fans just dey laugh like say she knack hat-trick gist.
Before Brighton, madam dey hold post for Paris FC four years. No be beans, she dey play UEFA Women’s Champions League back-to-back, 16 matches in just three years. She carry that European ginger reach England now.
And abeg no forget, before she pack load go obodo oyibo, she don win league with Rivers Angels for Naija plus three Nigeria Women’s Cup. She no be learner.
Recently too, she follow Super Falcons knack 10th WAFCON title – na history be that.
If na Ronaldo, dem for dey shout “Siuuu,” but for Chiamaka side, e be like “Goalkeeper wey be wall, no be door.”
How Chiamaka Nnadozie Take React
Instead make she cry, she turn everything to comedy. See wetin she post for her socials with correct pidgin:
“At this point, una fit go find another person wey go dey make una proud, because me I don tire. Which kind preseason be this naa 😂😂. If I survive this week, na Thanksgiving straight. People wey don play ball for England before, una no give me full expo 😂😂.”
Translation for Queen’s English people: “This training no get joy. Abeg if una no see me, know say preseason finish me.”
Na so e be, my people. Brighton fans don buy better goalkeeper, but for preseason matter, na Chiamaka dey learn say English football no dey smile.
She go still adapt, no shaking. After all, if Super Falcons fit hold England Lionesses for World Cup, why Chiamaka no go hold Brighton goalpost steady?
.@NadozieChiamaka down to business between the sticks! 🧤🇳🇬 pic.twitter.com/6gd602syfx
— Brighton & Hove Albion Women (@BHAFCWomen) August 18, 2025
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 19, 2025 2:25 pm by Hitvibz Media



Stay connected