Super Falcons star, Asisat Oshoala, show say she be “Agba Baller” again for Thursday night. She nak three goals (hat-trick) take help Al-Hilal waya Al Qadsiah for the second leg of their SAFF Women’s Cup semi-final match.

Asisat Oshoala scores against Al Qadsiah for Al Hilal

Oshoala first wire two goals for first half, and na she even open floor with the first goal. For second half, she complete the hat-trick as Al-Hilal take 5-1 hammer their opponent, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Asisat Oshoala Hat-trick don carry Al-Hilal go Final

This heavy win mean say Al-Hilal don qualify with 7-2 aggregate score.

Our Naija sister don dey fire since! For her last eight matches, she don involve for 13 goals. The way she dey take find net just dey wonder person.

Asisat Oshoala celebrates hat-trick for Al Hilal in SAFF Women’s Cup

This season alone, Oshoala don score 12 goals for the Saudi Women’s Premier League. If you count everything together, she don get 29 goal contributions—that is 23 goals and 6 assists for both league and cup matches.

  NWFL Premiership 2025/26 Don Set: 13 Facts Wey You Need Know Before Ball Start

Al-Hilal Finish Al-Qadsiah Patapata

The former Barcelona Femení striker no dey joke at all. For all competitions this season, she don score 23 goals total—6 for Saudi Women’s Challenge Cup and 5 for the Saudi Women’s Cup.

Before the match start, Al-Hilal chest dey land because dem win 2-1 for the first leg. But for this second leg, dem just over-run Al-Qadsiah with better “atilogwu” football.

  Super Falcons star Blessing Nkor wire goal again as Dynamo Brest scatter Belshina Bobruisk

Oshoala open door for the 36th minute, and just two minutes after, Jessica Silva add another one.

Ajara Nchout try show face for Al-Qadsiah as she score one goal for 42nd minute, but Oshoala quickly reply with her second goal before halftime.

For second half, the Naija star show dem say she be boss as she complete her hat-trick for 73rd minute.

Asisat Oshoala with her hat-trick ball after Al Hilal 5-1 Al Qadsiah match

As match wan end, Ghizlane Chebbak come score penalty for stoppage time take wrap everything up.

Now, Oshoala and her teammates go jam their big rivals, Al Nassr, for the final. Al Nassr move go final after dem beat Al Ula 5-1 on aggregate.

  Joy Omewa Still Dey Burst Net as Fortuna Hjørring Scatter Breidablik for Europa Cup
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on May 7, 2026 8:52 pm by Hitvibz Media