Naija Women’s Football League (NWFL) Premiership don reach land after all the kata-kata for Matchday 18.

Ekiti Queens stun Bayelsa Queens 1-0

As things stand now, we don sabi the six teams wey go play the Super Six playoffs, and we don also see the five clubs wey don fall hand, as dem drop go relegation, na weytin hitvibz dey yan be dat.

NWFL Title Chasers: The Super Six Squad

The runs for the league trophy don enter final stage as the top three teams from Group A and Group B don carry their bags enter Super Six.

Ekiti Queens 1-0 Bayelsa Queens

For Group A, the Big Three show say dem get level. Bayelsa Queens finish as chairmen for the top with 37 points—dem win 12 matches, draw one, and lose only three.

Even though Ekiti Queens give dem small shocker with 1-0 win for Ado-Ekiti, Bayelsa Queens still stay gallant for the number one spot.

Edo Queens and Rivers Angels join dem follow enter, as dem maintain steady form since the season start.

The biggest gist for Group A happen for Benin City, where Edo Queens knack Rivers Angels 2-1.

  Rivers Angels coach don blow hot before NWFL kick-off: “We go qualify for super 6, no shaking"

This win make Edo jump pass Rivers Angels for the final table, but the two of dem don already qualify before the match sef.

For Group B, FC Robo Queens surprise everybody as dem finish as leaders, leaving Nasarawa Amazons for second place. Robo Queens use 2-1 win take finish the job against the Nasarawa ladies for Lagos.

Better finish from Opeyemi Ajakaye and Oluwakemi Adegbuyi make sure say Robo finish the season with high head. Even though Nasarawa lose, dem still move go the playoffs.

Abia Angels na dem pick the last ticket to join the big girls wey go struggle for the trophy.

Abia Angels 0-1 Ahudiyannem Queens

Dem still enter Super Six even though dem lose 0-1 for home to Ahudiyannem Queens—na the points wey dem don gather since start of season save dem.

The NWFL Premiership Relegation Wahala

As the top teams dey jolly, heavy eye-water fall for the teams wey dey bottom. Total of five teams don commot for the top league:

  Naija Women Ball Don Set: NWFL 2025/26 Fixtures Don Land, Wahala Go Burst for Pitch!

From Group A: Pacesetter Queens and Naija Ratels.

The 1-1 draw wey Pacesetter and Naija Ratels play for the last match no help dem at all; the two of dem don officially drop.

Pacesetter Queens 1-1 Naija Ratels in NWFL Premiership

From Group B: Sunshine Queens, Osun Babes, and Confluence Queens.

The “Battle of the Bottom Pot” for Group B see Sunshine Queens beat Confluence Queens 2-0. But the win no sweet at all because the two teams, plus Osun Babes (wey Delta Queens knack 3-0), no fit escape the relegation zone.

Wetin Go Happen Next?

Now wey the survival struggle don end, everybody eye dey for the Super Six tournament.

The qualified teams go jam for Port Harcourt City to play round-robin format to see who go be the 2026 NWFL Premiership Champion.

Matchday 18: Scoreboard

FC Robo Queens 2-1 Nasarawa Amazons
Edo Queens 2-1 Rivers Angels
Delta Queens 3-0 Osun Babes
Ekiti Queens 1-0 Bayelsa Queens
Abia Angels 0-1 Ahudiyannem Queens
Sunshine Queens 2-0 Confluence Queens
Heartland Queens 1-0 Adamawa Queens
Remo Stars Ladies 2-3 Dannaz Ladies
Pacesetter Queens 1-1 Naija Ratels

The Teams wey Qualify for Super Six:

  Rivers Angels First Game Don Get K-Leg as Castmog Ladies Pack Bag Run Comot from NWFL

These na the teams wey go fight for the trophy and the chance to represent Nigeria for CAF Women’s Champions League:

– Bayelsa Queens
– FC Robo Queens
– Edo Queens
– Nasarawa Amazons
– Rivers Angels
– Abia Angels

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on May 7, 2026 11:31 am by Hitvibz Media