Lobi Stars don enter one chance—87 days no win, but coach say ‘we still dey build, we go fix am’

Lobi Stars

As wahala long like Lokoja-Abuja road, na so Lobi Stars own for NPFL be, e no gree end as dem chop another gbege, dis time na 1-0 loss for Bayelsa United hand for Yenagoa.

Lobi Stars defeat to Bayelsa United

One small mistake na e cost dem the match, and now dem never win for 87 days, Hitvibz reports.

With di team still dey bottom for table and big wahala dey come as dem go face NPFL leaders Remo Stars, e be like say dem matter don spoil.

But coach Tony Bulus still dey believe say tins go beta, even as dis na dem 16th loss dis season.

Lobi Stars gree make sleep catch dem again

Magbise Wisdom no waste time as e nack di only goal for di match just 10 minutes inside second half.

  Brown Ideye Dey Para For Nigerian Fans Wey Dey Hype EPL & La Liga Pass NPFL

Lobi Stars try do their own, but dem no fit use di chances wey dem get. Bayelsa United pack bus well, hold dem tight, and waka go house with three points.

Lobi Stars don enter one chance—87 days no win, but coach say 'we still dey build, we go fix am'

Coach Bulus wey take over after Mohammed Baba Ganaru waka comot early for di season, talk say na sleep dem sleep wey cost dem di match.

“Na because say we lose focus na im make we chop dat goal,” he confess. E still talk say Bayelsa United try post only once, but na di one wey enter. Meanwhile, e own team see chance, but dem no fit use am well.

16th loss dis season—Lobi Stars still dey find road or dem don lost?

For di 29 matches wey Lobi Stars don play dis season, dem don win only five times. E don turn to story of near miss and wahala for defence.

  Victor Collins: 'Remo Stars deserve respect sha, but dem go still see fire for Lafia' — Nasarawa United defender

Dis last loss na di fourth straight match wey dem go house empty hand, and di third time back-to-back wey dem lose 1-0.

Lobi Stars don enter one chance—87 days no win, but coach say 'we still dey build, we go fix am'

Di last time dem see win na for December, when dem manage beat Plateau United 1-0 for house.

Since dat time, na only four draws dem get, but di other eight matches na premium beating.

We still dey build di team. After dis match, we don see wetin we go do to make di team better,” Tony Bulus add.

Now, di next match go hard pass, as dem go jam table-toppers Remo Stars for Nnamdi Azikiwe Stadium.

  From NLO to NPFL? E-World United goalie Najeeb Saad don yan im big dream after promotion

Even as Bulus dey talk say di team still dey grow, time no dey again, and der chance to remain for NPFL dey hang like thread wey fit cut anytime.

You like dis post?
We go happy to hear from you. Drop your comment for di box below!

Last Updated on March 18, 2025 12:27 pm by Hitvibz Media

Be the first to comment on "Lobi Stars don enter one chance—87 days no win, but coach say ‘we still dey build, we go fix am’"

Leave a Reply