The Nigeria Premier Football League (NPFL) don show Kano Pillars pepper after all the raba-raba wey hapun for their home match against Rivers United.
For that game wey dem play on Sunday, April 19, 2026, things scatter for stadium as the home club no fit control the crowd, and this one lead to big security wahala and bad behavior from the fans, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Kano Pillars Face Heavy Wahala for Security Failure
The people wey dey run the league charge the club say dem no provide enough security, and this one make many people wey no get business for field enter where dem no suppose enter.
Because Kano Pillars no fit control the area, fans jump enter pitch come dey threat players and officials. Since this no be the first time such thing dey hapun, the NPFL fine the club ₦4 million.
Aside from the security mata, dem still fine Kano Pillars another ₦3 million because of how their fans take behave wey bring shame to the game.
NPFL talk am clear say everyone safety for match day na important thing, and since the club no fit handle their supporters, dem must pay the price.
Empty Stadium and More Fine for Fans Misbehavior
The mata worst as supporters go dey harass and threaten match officials. This kind bad character wey dey spoil the name of the league make dem give the club extra fines wey total ₦8 million.
This money cover for the way fans take disturb the center referee, how dem take stop the match, and the general failure of the club to guide their fans.
Because of all this ugly incident, Kano Pillars go play their next three home matches behind closed doors—meaning no fan go enter.
The ban go start from their last home game this season and carry enter the first two games of next season.
The club get 48 hours to appeal the judgment, but the league don send message say no room for fight-fight and intimidation for inside Nigerian football.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on April 21, 2026 6:49 pm by Hitvibz Media



Stay connected