The matter for Wisdom Gate International School for Port Harcourt don get another wahala inside as parents for the school don start to dey para oh!

Rivers State Ministry of Education seal on Wisdom Gate International School gate

Parents wey get children for di Campus 1 for Eligbolo, don carry voice join the matter. Dem dey beg the Rivers State Government make dem sharply settle the wahala wey make the school lock, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Wisdom Gate International School Wahala Dey Stress Other Parents

According to update from Wazobia FM Port Harcourt, many parents talk say to carry their pikin go other campuses far and transport money too much for this country hard time.

  Governor Wike has truly transformed Rivers - Adams Oshiomhole

Even though everyone pity the family of two-year-old Winnie Akekwe wey die, the parents for the school say things dey hard for dem.

Dem talk say the indefinite closure of Wisdom Gate International School dey affect their children learning and their pockets.

Many of dem no fit afford to dey send their pikin go far distance every day just because one campus lock.

Solemn assembly for Winnie Akekwe at Wisdom Gate International School

Remember say di Rivers State Ministry of Education don already shut down the place after the tragic incident wey hapun for March.

But now, parents dey ask if government fit find one temporary way make school open while investigation and court case dey go on.

  Rivers waste management agency to clamp down on scavengers

Controversy Wey Dey Trail Wisdom Gate International School Indefinite Closure

The big question wey many people for Port Harcourt dey ask now na: make school remain lock until investigation finish, no matter how long e take?

Or government suppose consider the other children for Wisdom Gate International School?

Proprietor of Wisdom Gate International School Toyon Obikoya begs government during interview

The Proprietor sef, Toyon Obikoya, don already talk say dem ready to follow the law, but the parents say no oh! Say dey want quick action.

As the matter reach court so, the Rivers State Government never change their mind on the suspension sha.

  We must win 2023 election, nobody will thwart it - Governor Wike
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on April 21, 2026 12:03 pm by Hitvibz Media