Rwanda vs Nigeria: Time, Where You Fit Watch Am, and Why Super Eagles Must Win

Rwanda squad
Share this

Plenty people dey wait for di Rwanda vs Nigeria match, but e clear say time dey run out for Super Eagles inside dis 2026 World Cup Qualifiers.

Rwanda vs Nigeria prediction

With only three points from four matches, dem gas find way turn tins around sharp sharp.

Dem go face Group C leaders Rwanda, wey go get full home support for di big Amahoro Stadium.

E go be survival battle—Super Eagles go rise, or e go be another heartbreak?

Rwanda vs Nigeria: Time, venue, and where you fit watch am

Dis crucial match go shele for di 45,508-capacity Amahoro Stadium for Kigali. Kickoff na 5 PM Nigerian time.

Nigeria vs Rwanda: Time, Where You Fit Watch Am, and Why Super Eagles Must Win

If you no fit waka go Rwanda, you fit watch am live for pay TV inside Nigeria. Plus, Hitvibz go run live updates for di match.

Prediction: Super Eagles fit escape dis wahala?

Rwanda dey top Group C with seven points, and if dem win, dem go lock di top spot. With dia home fans behind dem, e go be serious gbege for Super Eagles.

Rwanda vs Nigeria: Time, Where You Fit Watch Am, and Why Super Eagles Must Win

Meanwhile, the correct new Super Eagles coach, Eric Chelle, go wan start im reign with better result. If Nigeria no fit win dis one, wahala go gas for dia World Cup hopes.

Na do-or-die match for Nigeria. If dem show better teamwork and ginger, dem fit collect di three points.

But make nobody underate Rwanda—dem no go gree lie down. E fit be tight match, but Nigeria get di firepower to grind out di win—if dem play dia card well.

Our Prediction: Rwanda 1-3 Nigeria

You like dis post?
We go happy to hear from you. Drop your comment for di box below!

Leave a Reply