Super Eagles star Frank Onyeka don finally find net, and he do am with style as Coventry City beat Derby County for one winle-wanle match wey produce five goals.

Frank Onyeka ends two-year drought with rocket as Lampard’s Coventry boost promotion charge

The Nigerian midfielder long wait for goal end for inside Coventry Building Society Arena, and this one give the Sky Blues big hope for their season, na weytin hitvibz dey yan be dat.

​Frank Onyeka end two-year dry season with better rocket

​The ginger start just 12 minutes after match begin. Onyeka nack one heavy long-range strike wey fly straight into net. This na him first club goal since April 2024.

  Super Eagles hopeful Rafiu Durosinmi shine from bench as Sassuolo push Pisa closer to relegation wahala

​That goal show say the guy sabi work, and e remind fans why Frank Lampard hustle well-well to bring the former Brentford man come the club.

Frank Onyeka fire rocket end two-year goal drought

​Even though they score early, the match no easy at all. Derby County follow them drag am, as Brereton Díaz score to draw the match just before half-time.

​Second half turn to serious you-do-me-I-do-you struggle; Jack Rudoni score to put Coventry ahead again, but Díaz come nack penalty to make the score level once more.

​Lampard Coventry ginger for promotion chase

​As match remain ten minutes to end, Rudoni strike again to collect the 3-2 win.

  Super Eagles allow Jordan chop draw, Emmanuel Fernandez score and Alex Iwobi collect red card

​This result mean say Coventry still dey sit for head of Championship table as they dey push to go back to Premier League.

​Since Onyeka join them on loan for February 2026, he don dey show pepper for midfield, and him coach don dey call am “outstanding” player.

​The matter big for the midfielder o. If Coventry fit enter Premier League, the loan deal go automatically turn to permanent sign-on.

Frank Onyeka celebrating his goal

With the way he dey play so and how he dey balance midfield plus goals, e be like say that permanent move don almost sure.

  Super Eagles Scatter Show for Morocco – Osimhen, Akor and Ejuke Humble Gabon for World Cup Playoff

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on April 4, 2026 12:43 pm by Precious Akawor