Super Eagles head coach Eric Chelle no hide him mind after Nigeria clear Algeria 2-0 for AFCON 2025 quarter-final. Even though the win sweet well well, Chelle talk say more work still dey ground and higher standard na must if dem wan go far.

Super Eagles beat Algeria

For post-match press conference, Eric Chelle block any talk about bonus matter sharp sharp. According to am, him full focus na the match against Algeria and nothing else, na weytin hitvibz yan be dat

Eric Chelle keep Super Eagles head correct after Algeria win

The Super Eagles coach talk say the plan na to play serious football — and the players deliver.

  Emmanuel Dennis: Super Eagles Forward Wey Everybody Don Forget Don Show Face for Danish Club

Chelle praise the discipline and hard work of the team, but warn say dem no suppose relax. For am, success for AFCON 2025 no be about one good game, na about consistency.

Second-half goals from Victor Osimhen and Akor Adams seal the win for Super Eagles. Osimhen break the deadlock for 47th minute with clean header after fine cross from Bruno Onyemaechi.

Akor Adams scores as Eric Chelle Super Eagles pip Algeria in AFCON 2025

Ten minutes later, Osimhen turn provider, give Adams sweet pass. Adams run round goalkeeper and slot the ball enter empty net to make am 2-0. Osimhen correct display earn am Man of the Match award.

But even with the strong performance, Eric Chelle talk say work never finish.

  Omicron: Canada place travel ban on Nigeria

Na very good game. We play well and win, and I dey proud of the players. We dey work hard and we deserve the win, but na just one game. If you wan remain ambitious, you gats work again. Big match dey come in few days, so we go continue to work,” Chelle talk.

AFCON 2025 dream continue as Super Eagles face Morocco

Akor Adams hugging Victor Osimhen after both scored against Algeria

Next stop for Super Eagles na big semi-final clash against host nation Morocco on Wednesday, January 14, as dem chase fourth AFCON title.

The other semi-final go see Senegal face seven-time champions Egypt.

  Peter Olayinka: From Champions League Baller to Cyprus — Super Eagles Star Don Join APOEL

For Eric Chelle, message clear pass: good performance sweet, but na only high standard and steady work go bring trophy.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on January 12, 2026 5:20 am by Hitvibz Media