Super Eagles no slow down for AFCON 2025 as dem yan Algeria 2–0 for quarter-final wey happen for Marrakech. Na correct statement win for Nigeria — full control, records break, and Victor Osimhen still dey show why him be main guy.
Make we break am down, na six main things wey stand out from the match,
Osimhen Collect Man of the Match
Victor Osimhen chop Man of the Match after him scatter Algeria defence from start to finish. Baba play complete football — press, run, lead attack, na weytin hitvibz yan be dat dey there.
Na him first MOTM for this tournament, and e just prove say Super Eagles no fit do without am for this AFCON.
Osimhen Near Yekini Record
Osimhen don dey just two goals away from Rashidi Yekini historic record. Yekini score 37 goals for Nigeria in 62 matches, and that record don stand since old days.
With the way Osimhen dey hot now, breaking that record for this same tournament no be dream again — e dey very possible.
Back-to-Back AFCON Semi-Final
This win don confirm say Nigeria don enter AFCON semi-final back-to-back. That one show say Super Eagles dey consistent and dem be serious title contenders.
No be fluke, no be luck — na standard.
5 Straight Wins — Dem Don Make History
For the first time ever for AFCON history, Nigeria don win five matches back-to-back in one tournament.
Dem beat Tanzania, Uganda, and Tunisia for group stage, hammer Mozambique for knockout, now follow add Algeria join.
This one show say this team get discipline, clear tactics, and serious confidence as dem dey chase fourth AFCON title.
Super Eagles vs North Africa — No Fear
Nigeria don already beat two North African teams for this tournament — Tunisia and Algeria.
Next na Morocco for semi-final. Big question now be: can Super Eagles knock down third North African side and enter final? From wetin we dey see, nothing dey stop dem.
Algeria No See Ball Touch
Stats show how Nigeria control the whole match. Super Eagles fire 13 shots, three enter target. Algeria try five times but no even get one shot on target — first time dem go blank like that for this AFCON.
Nigeria lock everywhere. No breathing space.
With momentum full ground, confidence high, and Osimhen leading from front, Super Eagles don enter semi-final with belief say history dey wait for dem.
AFCON 2025 fit still end with green-white-green glory.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on January 12, 2026 5:19 am by Hitvibz Media




Stay connected