Super Eagles of Nigeria don carry dem waka go next level as dem beat Algeria 2–0 for AFCON quarter-final wey happen for Marrakech on Saturday night.

Super Eagles beat Algeria in AFCON quater final

Na clean, confident and correct performance wey show say Nigeria serious to win dem fourth Africa Cup of Nations title, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Super Eagles Hold Ball, Press Algeria but Goal No Show First Half

Nigeria control the match from start to finish, and when chance finally show, Victor Osimhen and Akor Adams no dull at all as dem score the goals wey carry Super Eagles enter semi-final.

From first whistle, na Super Eagles dey dictate how the game go. Dem press high, hold ball well-well and no allow Algeria settle for the opening minutes.

Semi Ajayi in action vs Algeria

Ademola Lookman almost break the deadlock after im shoot from edge of box, but Algerian keeper Zidane stop am.

  Paul Onuachu Don Enter Double Figures, Help Trabzonspor Win Again vs Konyaspor

Small time later, Calvin Bassey close to score from close range, but defender clear the ball for line. VAR check am finish, still no goal.

Akor Adams still get better chance after Algerian defence mess up, but im shot waka pass goal post small. Even as score still remain 0–0 for halftime, na Super Eagles get all the better chances and control.

Osimhen and Akor Adams Finish Work for Super Eagles

Just two minutes after second half start, Victor Osimhen open scoreline sharp sharp.

  “I happy well-well” — Tolu Arokodare talk as him score third Premier League goal for Wolves

Super Eagles beat Algeria

Bruno Onyemaechi send correct cross come box, Osimhen jump pass everybody nod am enter net. Na im fourth goal for the tournament and perfect way to resume.

Ten minutes later, Super Eagles hit again. Alex Iwobi scatter Algeria defence with fine pass to Osimhen.

The Galatasaray striker hold am well, beat im marker, then square ball give Akor Adams. Adams round goalkeeper and finish am calmly make am 2–0.

From there, Nigeria control everything. Dem tight for defence, sharp for counter and no give Algeria space to do anything meaningful.

Alex Iwobi in action vs Algeria

Final whistle confirm big win and many people agree say na Nigeria best performance so far under coach Eric Chelle, as Super Eagles fly enter AFCON semi-final with confidence.

  “Make e Continue Like Dis” — Ademola Lookman Body Dey Sweet Am as Atletico Madrid Silence Barcelona for Camp Nou

Big win for Super Eagles for Marrakech! Dem scatter Algeria Desert Foxes well-well to enter semi-final. Na Atlas Lions of Morocco, the hosts, dem go face next.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on January 10, 2026 7:06 pm by Hitvibz Media