Sadiq Umar show say him be confirm player on Tuesday evening, as him score important goal to help Valencia drag draw for Mallorca house after dem first fall hand.
The Super Eagles striker find net for that equaliser as Valencia carry 1-1 result comot for Estadi Mallorca Son Moix, dem escape wetin for be clean defeat, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Sadiq Umar Save Em Team Face for Mallorca Draw
Even though the match tough and Sadiq lose 11 duels (the highest for the game), the guy no gree.
Him wait for the right time, use head wire the ball enter net to make sure say him team no waka go house empty-handed.
For this Round 33 match, the 29-year-old Nigerian score him second La Liga goal for this season.
If you count all him work, him don get hand for six goals—two goals and two assists for league, plus another two goals for Copa del Rey.
The match hot well-well, and as things be so, the two teams still dey struggle to comot for relegation zone as the season dey go end.
Umar and Valencia Fight for La Liga
Mallorca start with ginger, dem control the first half as Sergi Darder and Vedat Muriqi dey give Valencia wahala.
The away team find am hard to create chances and dem no even get one shot on target before half-time.
Mallorca finally score first for early second half when Samú Costa use head nack Darder cross enter net for 49 minutes.
But Mallorca no fit add more grease to their elbow. Valencia goalkeeper, Stole Dimitrievski, do well as him save Jan Virgili and Muriqi balls, come keep him team for the game.
Valencia struggle enter late for the match, and e pay dem. Subs Luis Rioja and Javi Guerra join body set up Sadiq Umar, and the guy use power head the ball enter net to draw the match.
Las las, the two sides share point. Umar and em team still dey 13th position, dem just gap Mallorca (14th position) with one point, and six matches remain for this 2025/26 La Liga season.
Mallorca self dey try, but dem only get three points gap from the people way dey relegation zone.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on April 21, 2026 9:04 pm by Hitvibz Media


Stay connected