VAR wan crase? Cyriel Dessers tear net, assist as Rangers show Jose Mourinho say no be by gra gra

Cyriel Dessers scores in Europa
Share this

VAR don start wahala again! Cyriel Dessers shine like star for Rangers as dem nack Jose Mourinho Fenerbahçe 3-1 for Europa League.

VAR wan crase? Cyriel Dessers tear net, assist as Rangers show Jose Mourinho say no be by gra gra

E no just score early goal, e still dash assist wey help Rangers secure beta win. But wahala no end there—VAR comot two of e goals, Hitvibz reports.

Cyriel Dessers show Jose Mourinho say ball no be by gra gra

Rangers no waste time to show say dem no come play for Şükrü Saracoğlu Stadium. Just six minutes after kickoff, Fenerbahçe defence do error, and Dessers use am well.

Mohammed Diomande give am correct pass, and e use one sharp shot enter bottom right corner. Home fans shock!

Cyriel Dessers tear net for Europa

To add pepper, Dessers carry im celebration go front of Fenerbahçe fans—e do Mauro Icardi iconic pose.

As if dat one no do, im countryman Leon Balogun enter match for 28th minute after Robin Propper woundjure.

Fenerbahçe try fight back as Alexander Djiku use acrobatic finish equalize, but Rangers no gree.

Just before halftime, Dessers show say e no just sabi score, e sabi assist too. E give one correct pass to Vaclav Cerny, wey sharply fire ball enter net to make am 2-1.

Dessers

VAR wahala come kuku deny Cyriel Dessers hat-trick

Second half never tey, Rangers dey find third goal. 51st minute, Dessers see beta chance, e no dull—e hammer ball enter net. But before e fit celebrate finish, VAR raise hand say baba—na offside oh!

E no reach five minutes again, Jefte give Dessers clean pass, and e fire am enter bottom left corner. As e dey happy say e don finally get brace, the werey VAR strike again—offside!

Rangers no allow VAR spoil dia momentum. 81st minute, Cerny run solo, tear net again, seal the victory for Rangers.

Cyriel Dessers tear net

Cyriel Dessers wey suffer for VAR hand, still collect standing ovation before dem comot am for 88th minute.

Super Eagles striker dey on fire

Dessers form dey mad right now—21 goals and five assists for season, including four goals inside last three matches.

With World Cup selection near, e dey show say e deserve Super Eagles shirt. At 30 years old, e still dey ball like young star, and Rangers fans go dey expect more fire from am.

Like this post?
We’d be delighted to hear from you. Please leave a comment in the box below!

Leave a Reply