Super Eagles of Nigeria don start their AFCON 2025 journey well as dem grind out 2–1 win against Tanzania on Tuesday night for Fez. Na match wey get tension, chances plenty, but na composure and small magic later decide am.

Super Eagles of Nigeria 2-1 Tanzania

Nigeria control most part of the game, especially first half, but dem still need fight back after Tanzania equalise before dem finally carry all three points, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Super Eagles Take Charge Early Against Tanzania

From kickoff, Super Eagles show say dem serious. High press, quick recovery, sharp passing — na clear sign of Eric Chelle handwork.

Super Eagles celebrate goal vs Tanzania at AFCON 2025

Anytime dem lose ball, dem dey win am back sharp sharp, no give Tanzania space to breathe.

Akor Adams start the wahala early. One shot saved, later him header from corner go bang crossbar.

  Super Eagles Baller Emmanuel Dennis Don Get Injury Wahala as Brøndby Winless Run Reach 7

Victor Osimhen still try him luck but Tanzania defender clear am off the line as Nigeria continue to knock door.

The pressure finally pay off for 36th minute. Corner kick come in, Semi Ajayi jump pass everybody and nod the ball enter net from Alex Iwobi fine delivery from left side. Na correct reward for Nigeria dominance.

Semi Ajayi celebriting his goal vs Tanzania.webp

First half end:
🇳🇬 1–0 🇹🇿

Lookman Magic Seal AFCON 2025 Opener

Second half just start when Osimhen score, but referee cancel am for offside.

  Fisayo Dele-Bashiru Show Skills, Chop Better Assist as Lazio Pip Bologna for Coppa Italia

As Super Eagles still dey vex, Tanzania shock everybody for 49th minute as M’Mombwa fire one clean shot enter net to make am 1–1.

But Nigeria no waste time. Just three minutes later, Ademola Lookman carry matter for him head.

From outside the box, the winger release one wicked shot wey bend enter top corner — goalkeeper just dey look.

Ademola Lookman scores winning goal for Super Eagles

Another assist for Alex Iwobi, wey really control the tempo for midfield.

From there, Super Eagles calm down, defend together, manage the game well, and make sure say Tanzania no see road again.

Full time:
🇳🇬 2–1 🇹🇿

Strong start for Nigeria, and confidence don boost as AFCON 2025 dey move forward.

  Samuel Chukwueze don land from AFCON, fire Fulham comeback with im 7th goal contribution

Semi Ajayi MOTM vs Tanzania

Na Semi Ajayi carry TotalEnergies Man of the Match go house. Guy ball well well, deliver correct performance from start to finish.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on December 23, 2025 9:15 pm by Hitvibz Media