Just few days after dem call am for Eric Chelle 54-man Super Eagles list for AFCON 2025, Philip Otele no even talk too much — the guy just enter pitch go burst net as FC Basel nack FC Grand-Saconnex for Cup match.Philip Otele celebrating his goal in Swiss Cup for Basel

E no just ginger Basel alone; e still boost him own strong application to follow waka go continental showpiece wey go shelle this December, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Philip Otele light Basel comeback for Swiss Cup

Otele carry him shoulder high for this comeback wahala, drop the kain moment wey calm everybody mind and turn the match back to Basel side.

Philip Otele scores freekick goal in Swiss Cup for Basel

Na him score the second goal wey help Basel survive the stubborn Promotion League team as dem waka enter quarter-final for Swiss Cup on 4 December 2025.

Dem beat Grand-Saconnex 3–1. Na him first goal for two Cup games this season.

This season, the 26-year-old don gather four goals and three assists for 15 Super League matches, plus two goals for five Europa League showings — total goal contribution don hit ten.

But the match no start easy. Grand-Saconnex shock the home fans as Jules Matuvunu equalise three minutes after Bénie Traoré first burst net.

  Super Eagles coach Eric Chelle dey jubilate for Rwanda win: “Na we dominate dat match”

Na for 58th minute everything change. Otele stand for free-kick, lash am low and sharp, restore Basel lead 2–1. Ten minutes later, Traoré add another one seal the deal.

Philip Otele strengthens AFCON 2025 push with goal

The victory sweet Basel well, especially as dem don dey suffer four straight matches without win — two draws, two losses.

With this fresh ginger, dem go now set to face Winterthur for Super League Round 16 on Sunday.

Uchenna Ogundu shine scatter for Turkish Cup

Na the same vibe for Turkish Cup Round 4 one-leg match, as Uchenna Ogundu carry Alanyaspor for back and run am to a 5–0 demolition of Çorum FK.

  Zaidu Sanusi reach new milestone for Porto, but Nottingham Forest don spoil di celebration

Uchenna Ogundu leads Alanyaspor Turkish Cup win

Ogundu open the scoring and na him first goal for the competition, plus e join increase him season tally to four goal contributions (three goals, one assist in 14 games).

The 19-year-old no even wait for referee blow sweat; inside the first three minutes, him don send ball inside net.

But soon, Steve Mounié steal the whole show — guy drop hat-trick inside 38 minutes, come still add number four later to carry them go next round.

Monday Etim burst double for Cupa României

For Romania that same day, Monday Etim vex gan, drop two goals wey push Universitatea Craiova to hammer Petrolul Ploiești 4–0 for Cupa României Group B match inside Stadionul Ilie Oană.

Monday Etim celebrates Cupa României brace

The 27-year-old wey get only one goal for nine Superliga games this season, just land this Cupa României debut come score two straight.

Craiova start the game like people wey no come joke. For 10th minute, Oleksandr Romanchuk blast opener after corner.

  Frank Onyeka: From Premier League bench-warmer to 2025/2026 EFL Champion inside 78 Days

Eight minutes later, Etim double the lead with one clean low shot from outside box.

Second half na cruise for Craiova. Etim come still add him second for 57th minute scatter Petrolul hope finish.

For 87th minute, Anzor Mekvabishvili add number four complete the domination.

With the win, Craiova jump reach six points and climb top of Group B after two matches.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on December 5, 2025 7:28 am by Hitvibz Media