Fulham midfielder Alex Iwobi don open up about Troost-Ekong and him sharp sharp waka commot from Super Eagles, one news wey scatter emotions for camp as dem dey warm up for AFCON 2025.

Troost-Ekong Say Super Eagles Go Show Dia Power for World Cup Playoff: "We Don Set"

Everybody for naija just dey do “chai!” because nobody see am coming, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Troost-Ekong confirm say him don retire from international football after 83 caps, and the guy comot just two weeks before Nigeria go begin their AFCON campaign.

See timing wey go make person shout, “Wetin happen, skipper?!”

Alex Iwobi trowback how Troost-Ekong take hold ground for Super Eagles

This shock sef strong because Troost-Ekong name dey inside the 54-man provisional list, so the announce come be like when generator stop during penalty shootout — unexpected.

Super Eagles star Alex Iwobi speaks on AFCON hopes

For the interview wey him yarn with SportyTV’s Kelechi, Iwobi no hide him feelings. The guy talk say the 32-year-old former captain dey important well-well, both for field and outside field.

Obviously it is a sad one for us because he is a big part of our team. But at the end of the day I wish him well; he is a brother, and he has helped Nigeria and me,” he said.

“I just hope that the next chapter he has in life goes well for him, and we will all support him.”

“Him voice” and more — wetin Iwobi talk say he go miss

When dem ask whether Ekong commot go leave big hole for team, Iwobi yarn truth:

  Christantus Uche No Dey: 10-Man Leeds Hold Crystal Palace for Selhurst Park

Even though Ekong no dey play regularly toward the end of him Super Eagles career, the guy still be big leader wey dey hold dressing room like bouncer.

“He wasn’t playing as much as probably he would like, but he was still a big part of our team – his voice, the way he was leading us and the way he made sure the togetherness in the team was very high and very strong,” Iwobi said.

Iwobi even add say the guy presence for dressing room na like when senior man enter beer parlour — everybody go comport.

  Super Eagles scatter World Cup dream as DR Congo knack dem like carpenter for penalty

Mikel Obi don talk to Super Eagles players for Gabon matter

So he will be very missed; he was a big leader for us, and I am sure we have other leaders that can follow in his footsteps, but we all wish him well,” he added.

As one of the senior boys now, Iwobi talk say him go carry more responsibility for the upcoming AFCON.

God willing I stay fit. I will be there representing in the AFCON, and also we would be fine for Nigeria and Wil as well. He would be there in spirit,” he assured.

Nigeria go battle Tunisia, Uganda, and Tanzania for Group C when the tournament go kick off on December 23.
Omo, e go be fire.

  AFCON sidon-look Rafiu Durosinmi shine again, close 2025 with killa goal for Czech League
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on December 5, 2025 4:06 pm by Hitvibz Media