Former Naija striker Yakubu Ayegbeni don yan straight tori: Super Eagles no gree dey turn back, make dem give current coach Eric Chelle full support as AFCON dey waka come.
For Bet9ja Home Turf Podcast, the ex-Everton striker no hold back, talk say Naija need fresh direction instead of dey call back all those familiar coaches wey dem don already use before, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Yakubu Ayegbeni Dey Support Chelle, Reject Old Coaches
As talk dey grow say maybe another coach go enter, Yakubu don drop hammer: now no be the time to bring in new coach.
“We dey yan about new coach now. I think say make we just allow Eric Chelle handle the team go AFCON. E too near to dey change coach now.
Dem dey talk say make we bring Austin Eguavoen. I no see reason for Samson Siasia or Eguavoen again. That time don pass. Na that era don finish.”
Yakubu yan say Super Eagles must dey look front, no dey repeat old story. E even shade Eguavoen, say the guy don dey camp three, four times but the result never too sweet.
“Eguavoen don dey there like three, four times. But if you check record, e no too deliver. Better make we forget am, sit down look who fit run this team well, make dem carry us go far.”
“We Dey Move Forward, No Dey Look Back” — Yakubu
Yakubu, wey score over 20 goals for Naija and shine for Premier League with Portsmouth, Middlesbrough, and Everton, talk am clear: respect no mean make we dey live for past.
“We dey move forward; we no dey go backward. Bring those people back — Siasia, I no get wahala with am. Eguavoen sef dey my coach before, I swear, Benin City time, I swear.
But e better make we dey look front, carry anybody wey fit take care of us, make dem run us go far.”
For Yakubu, Naija football no need dey play memory lane. Progress na the key, nostalgia na only gist for bar.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on November 21, 2025 5:32 pm by Hitvibz Media



Stay connected