Super Eagles forward Anayo Iwuala don start new year gbedu style as he knack goal make Al-Arabi carry 2–1 W come from Yarmouk for Kuwaiti Crown Prince Cup Round of 16 single-leg game Wednesday night.

Anayo Iwuala celebrates his goal for Al-Arabi against Yarmouk

The 26-year-old Naija attacker open scoreboard for Sabah Al Salem Stadium, set tempo as Al-Arabi waka fight finish for deserved win, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Anayo Iwuala Goal Push Al-Arabi Pass Yarmouk

Iwuala goal na him second in three games for club, after e don help dem win 2–1 over Al-Tadamon December 28, 2025.

Al-Arabi secure ticket go next round of Crown Prince Cup with hard-earned 2–1 W against Yarmouk, but the score no show half the wahala wey happen for pitch.

First half na war for midfield. Al-Arabi get more ball possession, calm pass Yarmouk for middle, but Yarmouk defend tight, no give clear chance.

  Paul Onuachu score again as Ndidi, Iwobi and Akor Adams show Super Eagles magic for Europe league

Anayo Iwuala Shines as Al-Arabi Edge Yarmouk

45 minutes finish 0–0, both team waka go break sabi say game dey balanced.

Second half come alive quick quick. Just 3 minutes after restart, Anayo Iwuala knack first goal for Al-Arabi.

Na perfect run and confident finish, as fellow Naija Christopher John deliver correct assist, knack Yarmouk backline shak.

Goal give Al-Arabi tempo and ginger. Momentum stay with defending champions, and e pay off 6 minutes later.

Al-Arabi chop penalty after heavy pressure inside box. Zaid Qunbar step up, bang spot kick for 54th minute, make am 2–0, control game well well.

  Tolu Arokodare Burst Everywhere, Score Goal + Assist as Wolves Tear Shrewsbury 6-1 for FA Cup

Yarmouk no gree give up. Dem push front, take risk, and finally win penalty for 76th minute. Dem convert am, make score 2–1, set tension for end.

Last minutes Yarmouk dey press for equaliser, but Al-Arabi dey manage game, hold defence tight.

Despite small wahala, Al-Arabi hold finish, carry 2–1 win.

Arokodare for Premier League

Tolu Arokodare in action for Wolves in Premier League

For Premier League, Tolu Arokodare play full 90 minutes for Wolves as dem hold Everton 1–1 away.

25-year-old forward however get lowest touches (35) for outfield players wey play whole game.

Okoye Shine for Udinese Win

Maduka Okoye making key saves for Udinese in Serie A

For Italy, Maduka Okoye stand gidigba for goal as Udinese knack important 2–1 away W against Torino for Serie A.

  Tolu Arokodare Scores Second Premier League Goal, but Chelsea and Cole Palmer Too Strong for Wolves

Goalkeeper wey miss AFCON 2025 slot make more than 3 big saves and clear two important balls for 90 minutes.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on January 8, 2026 10:29 am by Hitvibz Media