After he fire goal inside the 3-0 win against Semi Ajayi Hull City back in March 14, Super Eagles forward Josh Maja don show face again for West Bromwich Albion scoresheet. But even as he score, e no reach to help the Baggies carry all the three points.
Maja double the lead for the home team from penalty spot to make the game look like say West Brom don win, but he only fit look as him side fall hand, throway the 2-goal lead come settle for 2-2 draw for house, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Josh Maja deliver but West Bromwich Albion just lose control
The 27-year-old striker don get three Championship goals this season and one assist join. This him latest goal mean say he don get hand for six goals this season, if you follow the two wey he score for FA Cup join.
As Maja dey carry shine with him fine finish, another Naija boy, Arthur Okonkwo, stand gidigba for Wrexham goal. He make sure say the two teams share the points for this hot EFL Championship match.
Wrexham show say dem get liver for The Hawthorns as dem fight back from two goals down to collect better 2-2 draw against West Brom.
Wrexham AFC fight back as Arthur Okonkwo spark comeback
The match start bad for the visitors; one own goal from George Dobson and Josh Maja penalty—wey happen after Issa Kabore commit foul—give West Brom 2-0 lead before halftime.
But Phil Parkinson boys come back with fire after break. Josh Windass start the comeback with one wicked strike from 20 yards, him 12th goal for the season.
Dobson come pay for the mistake he make first half as he touch Lewis O’Brien ball enter net to make the game 2-2.

Even though the two teams get chances to win am for die-minute—including one big save wey Okonkwo make to stop Daryl Dike—the match end for draw.
This result keep West Brom four points away from relegation wahala, while Wrexham climb go sixth position as dem continue to chase Championship play-off spot.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on April 4, 2026 4:13 pm by Precious Akawor


Stay connected