Super Eagles star Kelechi Iheanacho don show say he still be Senior Man as he enter from bench come score beta goal wey give Celtic 2-1 win against Dundee FC for Dens Park.

Kelechi Iheanacho comeback goal for Celtic Scottish Premiership

The Nigerian striker fire the ball enter net late for the match to pick all three points for this Scottish Premiership waka, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Kelechi Iheanacho show him level as he return for Celtic

This goal sweet pass anything because e end Iheanacho long dry season and e help Celtic bounce back after dem lose their last match.

Iheanacho enter the game for 58th minute, and e no waste time at all to show him face. The 29-year-old take only 24 minutes to calculate one calm finish wey settle the whole matter.

Celtic start the match with ginger, as Yang Hyun-Jun score first. Dem get plenty chances to finish the work but dem fumbuz the balls, and that one give Dundee hope to stay for the game.

  Super Eagles Don Finish AFCON 2025 Group Stage With 3-1 Win Over Uganda

For second half, Dundee come equalize through Simon Murray penalty after VAR check the matter, and the match come hot well-well as e remain small make e end.

As everybody think say the match go end for draw, Iheanacho come out like spirit come score the winning goal. This win carry weight because e keep Celtic for inside the title race.

Kelechi Iheanacho reacts after Celtic victory over Dundee

After the match, Iheanacho talk say him body dey sweet am as he fit help the team win.

“E sweet me say I help the team get this win today. But as one team, I think we show liver and we really work hard to get the result. E really sweet me for body say we win.”

Iheanacho gist about Celtic performance and the chances wey dem miss

The former Man City baller reason the match, he say Celtic for don finish the work since first half because dem overplay Dundee, but dem no fit convert the chances.

  Super Eagles star Frank Onyeka don talk why Coventry City be like him home since day one

I think, especially for first half, we finish dem. We get many chances to score but unfortunately, e no enter. For second half, dem come back inside the game come score penalty, but for the end, we carry the points and that one big well-well.”

This goal na Iheanacho number three for league this season, and na him first goal in over six months. He don play 12 games since October 2025 without scoring, but the dry season don end now.

Since he don stay for bench for some time, the striker talk say e important say he don dey back for pitch and he dey happy say he fit help when the team need am pass.

Kelechi Iheanacho celebrates winner for Celtic vs Dundee

E sweet me say I don return. I don dey outside for long time and e good say I dey back to help the team win today, so I dey happy.”

This Celtic win don make the gap between dem and the people wey dey lead the league remain only three points. As the season don reach where e dey hot, Iheanacho return go really help their attack.

  Tolu Arokodare Scores Second Premier League Goal, but Chelsea and Cole Palmer Too Strong for Wolves
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on April 6, 2026 4:58 am by Hitvibz Media