Rangers wey bin dey find Scottish League title, dem suffer serious gbege as dem fall yakata for Old Firm derby against bitter rivals Celtic, wey end 2-1 for Celtic favor, even as Cyriel Dessers still manage score goal again.Rangers Title Hope Don Scatter as Cyriel Dessers' Goal No Reach for Old Firm Derby Loss

Cyriel Dessers’ goal just be like small comfort, as John Lundstram’s own goal plus red card finish Rangers’ kpata kpata for di game, Hitvibz reports.

This loss now don make Rangers come dey six points behind Celtic, wey make their chance to win league title very slim.

  Peter Olayinka score but Apoel fall hand as Franklin Tebo ginger Crvena Zvezda fightback

The Light Blues go now focus on Scottish Cup final wey dey happen on May 25th, against Celtic, where dem go try win small something from their season.

The match bin start well for Rangers oh!! when Fabio Silva almost score for 21st minute.

But, Celtic begin gather sense, and Matthew O’Riley’s 15th league goal for the season give dem lead 14 minutes later.

John Lundstram own goal three minutes later carry more trouble land for Rangers head just like that, come make dem get serious work to do.

  Kelechi Iheanacho don Join Bursaspor as Super Eagles Star Start New Journey for Turkey

Dessers’ 21st goal for all competitions this season, wey come from fine header, give small hope to Rangers just before half-time.

But, Lundstram’s red card for yama yama-tackle on Alistair Johnson shortly after just finish their hope.

As e be now, na only two play-off games remain, but any hope remain for Rangers to still win title ? My brother!! E go hard small oh!!

Upon this yawa, Dessers still dey shine well well, and just in case you no know, the Nigerian striker don score 15 goals and give three assists for the league this season.

  Give Nigerians more exciting moments to celebrate - President Buhari to Super Eagles
You like this post? Abeg, we go happy well well if you fit drop your comment for the box wey dey down!

Last Updated on May 12, 2024 10:49 am by Hitvibz Media