Naija striker Rafiu Durosinmi don burst enter Serie A with style, as e score for him debut help Pisa fight back collect strong 1–1 draw against Atalanta wey get Ademola Lookman, on Friday night.

Rafiu Durosinmi in action on Serie A debut for Pisa

Durosinmi score equaliser for 87th minute, make sure say Pisa no lose for house, as dem grab correct point for Arena Garibaldi – Stadio Romeo Anconetani, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Rafiu Durosinmi burst ground sharp sharp for Serie A

The 23-year-old, wey just miss out from Super Eagles squad for 2025 AFCON for Morocco, no waste time at all to announce himself for Italy. Na just 19 minutes e take am do am.

Rafiu Durosinmi scores dramatic late goal versus Atalanta

As dem bring am come from bench, the guy show say e mean business, slot correct debut goal give im new club.

Former Viktoria Plzeň striker enter game for 64th minute, replace Henrik Meister, and that substitution later turn to gold, as e seal memorable first outing for Pisa.

  Christantus Uche No Dey: 10-Man Leeds Hold Crystal Palace for Selhurst Park

Pisa continue their record as draw specialists for Serie A, as this one make am 11th draw for the season. The result also stop Atalanta winning streak of three straight games.

First half no really get plenty action. Pisa hold ball pass Atalanta for front areas but dem no get final touch, while both teams struggle create clear chances.

Rafiu Durosinmi celebrates Serie A debut goal for Pisa

Late wahala as Durosinmi spoil Lookman Atalanta party

Idrissa Touré and Henrik Meister waste good chances, while Atalanta no even stress Pisa keeper Simone Scuffet at all. First half end as usual—0–0.

  Anayo Iwuala tear net, provide another one as Al Qadsia break Al Arabi heart for 7-goal Super Cup banger

Second half start with better energy from Pisa, as Stefano Moreo force Atalanta keeper Marco Carnesecchi make sharp save. Atalanta later respond through Giorgio Scalvini.

Drama come late when Nikola Krstović score for the visiting team with just eight minutes left, and e be like say game don finish.

But Pisa no gree. For late moments, Durosinmi rise well head Mehdi Léris correct cross enter net, level the score and secure deserved point for the home fans.

Rafiu Durosinmi heads late equaliser against Atalanta

The performance sweet so tey dem give am Man of the Match after final whistle.

After the game, Durosinmi talk say:

  Terem Moffi don drop strong message with him first goal as FC Porto hammer Arouca

I dey very grateful say this na my first game and I score goal. I just dey hope say many more go come.”

Correct way to start Serie A career.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on January 17, 2026 1:38 am by Hitvibz Media