My people, you remember Nyima Nwagua, the ex-captain wey dey scatter net for Rivers United?
The guy don finally open mouth give the real tori why e waka comot NPFL go Saudi.
And no be because say oil dey flow for there oh — na better hustle and adventure carry am go, na weytin hitvibz dey yan be dat.
The 32-year-old striker wey dey warm up for him second season with Saudi Division Two side, Al Sadd FC, yarn the matter after preseason friendly for PH.
“Rivers United Na My Blood,” Nwagua Talk Am Clear
Dem ask am whether e miss him old boys:
“Ah! I miss dem well-well. Rivers United no be just team for me, na part of my DNA. I dey from Rivers State, so na our own team be that. Once you don wear that jersey, na forever. I still dey follow all their matches. My guys still dey there. We still get our legend coach, Finidi George, so na love always.”
You no fit blame am — na with Rivers United e lift the NPFL trophy in 2022, just one year after e waka leave Kano Pillars join dem.
“Abeg, No Be Oil Money Carry Me Go”
Plenty people don dey whisper say na ‘Saudi oil money’ make am comot, but baba say make una park well:
“Any time you leave Naija league, dem go always think say na money-matter. But truth be say our league still dey grow. One day e go reach level wey dem go pay oil money for here sef. I just go for greener pastures, to test new ground. You no fit be champion for one corner forever.”
Translation: Baba wan play Champions League of life, no be just NPFL.
After him contract for Rivers United expire, Al Sadd FC grab am free of charge. Since then, guy man dey enjoy life for Saudi, but no forget home.
Before Saudi waka, Nwagua don rock jersey for Lobi Stars and Kano Pillars. E get 49 goals and 3 assists for 234 matches — local and continental combined.
E play that wahala 2018 Federation Cup final wey Kano Pillars mess up against Enugu Rangers, but e still bounce back win am the next year.
Still, na that 2022 NPFL title with Rivers United wey make am permanent legend for Bole and Fish City.
Now, even though e dey score goals under Saudi sun, e heart still dey PH, dey near water front, dey smell roasted bole with correct pepper fish.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 11, 2025 1:24 pm by Hitvibz Media






Stay connected