Nasarawa United coach don dey raise shoulder up after dem nack Remo Stars: ‘Dis team get big potential’

Nasarawa United coach don dey raise shoulder up after dem nack Remo Stars: 'Dis team get big potential'
Share this

Nasarawa United don show say dem no dey fear anybody for Nigeria Premier Football League as dem get mind go knack league leaders Remo Stars for Lafia.

Nasarawa United

See people wey dey struggle for relegation ooh!

But then, na wetin der coach Salisu Yusuf talk after di match go make der fans head dey turn dem—e say hin boys get better potential to survive relegation wahala, Hitvibz reports.

Anas Yusuf tear net, Remo Stars no fit hold am

Di match never even go far when Mubarak Hussaini send one wicked cross enter box for 25th minute.

Anas Yusuf, wey be di league top scorer, no waste time—e just run like who police dey pursue go push dat ball enter empty net for hin 14th goal dis season.

Anas Yusuf

Even person wey dem promise 40 million naira no fit score dat kind goal.

Na dat single goal give Nasarawa United di three points wey dem need badly. Remo Stars try find way equalize, but dem no fit break Nasarawa United defense.

As di final whistle blow, di Solid Miners run climb go 17th position with 30 points from 26 matches.

Nasarawa United coach Salisu Yusuf no dey fear relegation

After di match, Nasarawa United coach, Salisu Yusuf, halla say hin boys show correct determination.

Even though dem get only two days train, dem still execute em game plan well.

Nasarawa United coach don dey raise shoulder up after dem nack Remo Stars: 'Dis team get big potential'

“Na only few days we take prepare, but I tell di boys wetin to do. We use high press collect di goal, and I believe say dis team get big potential to grow,” Yusuf yarn.

E still talk say even though Remo Stars na big team for di league, dem no really fit create better chances.

“I dey proud of di boys. Di mission na to comot for relegation, and I believe say we fit do am,” e add.

Nasarawa United go now focus on dia next match against Abia Warriors on March 2 before dem host Sunshine Stars for Lafia di following week.

Like this post?
We’d be delighted to hear from you. Please leave a comment in the box below!

Be the first to comment on "Nasarawa United coach don dey raise shoulder up after dem nack Remo Stars: ‘Dis team get big potential’"

Leave a Reply