Rafiu Durosinmi no dey hear word! Em don tear net again as Viktoria Plzen scatter FC Zlín

Rafiu Durosinmi celebrating his cup goal
Share this

Rafiu Durosinmi no gree calm down did period oh! Di Nigerian striker don show say e no be anyhow baller as e fire another goal wey help Viktoria Plzen waka enter di next round for Czech MOL Cup.

Rafiu Durosinmi

E be like say na only net em sabi tear, because FC Zlín no fit hold am as Plzen run dem 4-1 for Thursday night battle, Hitvibz reports.

Stanley Kanu, anoda Naija baller, still find one goal put for Zlín side, but e no fit stop di wahala wey Viktoria Plzen carry come.

No be today Durosinmi dey deliver—e don already shake net with two goals wey give Plzen big win against Ferencváros for Europa League playoffs.

But after dem bench am for di 3-1 loss to Slavia Prague, e show say im no dey joke at all.

How Rafiu Durosinmi take run things as Viktoria Plzen scatter FC Zlín

Durosinmi no still start di match dis time around as Plzen wan use di game take clean dia eye after di Slavia Prague beating.

But na shock dem first see as Stanley Kanu give Zlín lead just one minute after kickoff.

Rafiu Durosinmi no dey hear word! Em don tear net again as Viktoria Plzen scatter FC Zlín

Plzen no gree carry last, dem push until Vaclav Jemelka balance di scores for 33rd minute.

E come be like film trick as both teams no fit knack another goal before full time, so extra time enter di matter.

Na just three minutes inside extra time, Durosinmi show face again—e jam ball wella, fire am enter net, come give Plzen di lead.

Rafiu Durosinmi enter di match for 68th minute, take over from Daniel Vasulin for Doosan Arena.

Di Naija striker no waste time at all—e just show say e sabi ball wella.

As e see say nobody mark am inside box, e jump like say e get spring for leg, come nack one correct header wey no give di keeper any chance.

As Zlín dey struggle to find way to equalise, Jan Kopic come kuku finish dem with two back-to-back goals wey end di game 4-1.

Viktoria Plzen don regain ginger before next matches

Rafiu Durosinmi no dey hear word! Em don tear net again as Viktoria Plzen scatter FC Zlín

Viktoria Plzen for even finish di game with 6-1, but VAR and referee no gree as dem cancel two goals.

First, Jan Kopic think say e don score for 69th minute, but dem cancel am say offside dey di build-up.

Later, Pavel Sulc self see im goal wipe commot after referee talk say di ball touch hand before e enter net.

Dis win don boost Viktoria Plzen morale as dem dey prepare for di next wahala against Mladá Boleslav for league match dis Sunday.

But di real kasala go burst when dem jam Lazio for Europa League next week.

One thing sure be say, as far as Rafiu Durosinmi dey form like dis, Viktoria Plzen go dey give teams serious headache.

Like this post?
We’d be delighted to hear from you. Please leave a comment in the box below!

Be the first to comment on "Rafiu Durosinmi no dey hear word! Em don tear net again as Viktoria Plzen scatter FC Zlín"

Leave a Reply