Na Naija striker, Rafiu Durosinmi, stand gidigba when e matter pass, as e score one late penalty wey help Viktoria Plzen beat Servette 3-1 for Switzerland on Wednesday night.

Rafiu Durosinmi don score winning goal for Switzerland

Dis win make dem waka pass with 3-2 agg for UEFA Champions League second qualifying round, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Rafiu Durosinmi Penalty Carry Plzen Go Next Round for Champions League

Di match start hot as Servette knack first goal for dia home turf, Stade de Genève.

Alexis Antunes fire shot for just 4th minute, join am with the 1-0 win wey dem already get from first leg — make e 2-0 on top agg.

Rafiu Durosinmi don Deliver di Last Blow wey help Viktoria Plzen shock Servette for Switzerland

But Plzen no gree. Two minutes no even pass, dem para back — Karel Spacil net one for 29th minute, then Matej Vydra add another one sharp-sharp for 31st.

  Philip Otele Don Design FC Basel With Goals – Fire Two Against Grasshopper

Boom! Na Plzen carry lead enter halftime.

Red Card, VAR Wahala & Durosinmi Cold Finish Close the Show

Second half na pure gbege. Adrian Zeljkovic chop red card straight for 66th minute — Plzen come dey with 10 men.

But no too long, Servette own man, Yoan Severin, collect second yellow — e balance up.

Rafiu Durosinmi dey celebrate Champions League penalty for Viktoria Plzen

As both teams dey find winning goal, Merchas Doski wey come from bench, make one sharp move enter box for 87th minute.

  Rafiu Durosinmi Break Em 7-Match Dry Spell, Help Viktoria Plzeň Wire Mladá Boleslav

Na there wahala burst — Magnin from Servette do error, foul Doski. VAR check enter matter, ref blow whistle — penalty!

Na so Rafiu Durosinmi hold him chest, no shake, slot the ball pass Joel Mall like say na training.

That goal burst everywhere — Plzen don qualify enter third round. Swiss fans just freeze.

Wetin Come Dey Next for Durosinmi and Plzen?

As dem win, Plzen go now jam Rangers from Scotland — wey just knack Panathinaikos with 3-1 agg.

Viktoria Plzen vs Servette for UEFA Champions League qualifier

If Plzen win, na straight Champions League group stage. If dem lose, na Europa League group dem go enter.

But anyhow e be, Durosinmi don already show say him be main guy for Plzen. E go still dey eye more goals as e dey carry Naija flag up for Europe.

  Rafiu Durosinmi: Super Eagles Future Pikin Don Complete Em Record Serie A Deal as Pisa Pepper Dia Rivals
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 31, 2025 9:13 am by Hitvibz Media