Victor Osimhen no just waka enter Istanbul — the guy land with gbege! Na Wednesday night the Nigerian striker show for Turkey with him madam and pikin, and from that moment, everywhere just bust.
The Galatasaray new ₦75M baller land and fans full ground like say na crusade. Cameramen, reporters, fans — everybody dey shout like say dem win World Cup, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Victor Osimhen Entry Turn Istanbul to Carnival
As Osimhen drop from plane, everywhere just change. People begin shout, carry placards, sing song — all for one man.
Na that kind love wey you no fit buy with money. Before you blink eye, the pictures wey dem snap don blow for social media. Twitter, Instagram, TikTok — all of dem dey boil.
This one no be just transfer. Osimhen carry statement come Turkey.
Later that same night, Galatasaray carry am go unveil — and dem talk say na the most expensive signing ever for Turkey ball.
₦75 million euros waka for this one deal, pass the former highest wey Fenerbahce pay for Youssef En-Nesyri (₦19.5 million euros). Osimhen no even waste time talk how him dey feel.
“I no even sabi how I go talk am. My belle sweet me wella. I don finally reach where I dey love,” na wetin Osimhen yan.
“This place na home. I dey happy. I wan thank the president, vice president, George Gardi and coach Okan Buruk. Big thanks to the fans wey beg make I come.”
“I dey ready to ball for Galatasaray. My story never end.”
Why Victor Osimhen Dey Turkey, No Be EPL or Saudi?
Even though big clubs for Europe and Saudi dey chase am with money and offer, Osimhen pick Galatasaray — all because of love.
— Galatasaray SK (@GalatasaraySK) July 30, 2025
The fans show am mad support, the management run things clean, and the welcome wey he get na like say dem dey wait for messiah.
As people dey talk, “Go where dem value you. If love dey choke, na home be that.”
The Galatasaray new ₦75M baller don sign four years contract with the Turkish giants. E go dey Süper Lig till further notice.
Vice president Abdullah Kavukcu talk say the club don dey plan Victor Osimhen package since January. Dem hustle funds wella without selling any player.
According to the guy:
“We pay part of the money now, the rest go land before next year end. People wey dey talk say na clout we dey chase suppose apologize. Galatasaray don show say our pocket dey heavy.”
Şşş… 🤫
1️⃣!
2️⃣!
3️⃣!CİMBOMBOM! 🙌 pic.twitter.com/DQa2SwfYp4
— Galatasaray SK (@GalatasaraySK) July 30, 2025
Him come end with big thanks to fans and beg make dem cool down. Say better players still dey come.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on July 30, 2025 11:27 pm by Hitvibz Media





Stay connected