Two Naija ballers, Terem Moffi and Ehije Ukaki, run things on Wednesday night as dem shine wella for OGC Nice 3-2 win over Sheffield United for preseason friendly.

Ehije Ukaki score di equalizer for Sheffield United preseason vs Nice

From comeback goals to sharp finishing, dem two no dull at all — dem ginger fans sotey everybody dey hail, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Terem Moffi Comeback Na Big Ginger for Nice

Moffi, wey still dey find full form after wahala with injury last season, score correct goal wey give Nice the lead.

As if dat one no do, young blood Ukaki, just 20 years old, scatter ground with better equaliser.

Terem Moffi dey celebrate em goal for Sheffield United vs Nice

Na real Naija takeover be this — dem show say dem ready scatter pitch this season.

The match start with Sheffield United first open scoring before 30 mins don waka.

One sharp corner from Gus land for Tyrese Campbell leg, and the guy no waste time — boom! Ball land for net.

  William Agada Help Real Salt Lake Scatter Club América, As Kparobo Arierhi Score Em First Goal

But before halftime show end, Morgan Sanson balance one for Nice, make am 1-1. That one give dem better morale enter second half.

Moffi No Dey Slack — Score Clean Goal

23 mins into second half, Moffi yan say e don do.

As Nice break, dem jam Moffi with better pass — the guy no waste time, bend one sweet left-foot shot enter net. Na so Nice take lead 2-1. Everybody feel am — Moffi dey back!

Ehije Ukaki Burst Everywhere With Calm Equaliser

Just five mins later, Ukaki enter the movie proper. After better hustle from Cannon, Ukaki stand gidigba, no shake, just place the ball inside net like pro — 2-2!

  Terem Moffi don drop strong message with him first goal as FC Porto hammer Arouca

Terem Moffi and Ehije Ukaki kuku shine for friendly game

Young boy show levels. This na talent wey go worry defenders this season.

OGC Nice Win Am Las Las

When everybody dey reason say match go end draw, na Harrison Burrows mistakenly carry ball enter him own net for 80th minute.

Na so Nice collect the win sharp sharp — 3-2. Five goals, better drama, full entertainment.

Wetin Dey Next for Moffi and Ukaki?

After this kind morale-lift win, Terem Moffi and Nice go face serious Champions League kwalifa match against Benfica.

As for Ukaki and him Sheffield United guys, dem go start dem Championship waka against Bristol City on Saturday, August 9.

  Elijah Odebe Still Hot Like Suya, But Sheriff No Fit Escape Anderlecht Wahala for UEFA

With the way Ukaki ball, fans and coach go dey expect more fire from am.

Naija boys don talk say dem ready for this season. Fans, make una siddon dey watch — more action dey come!

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 30, 2025 8:42 pm by Hitvibz Media