Odion Ighalo don finally score after 66 days but na ex-Chelsea baller land him and Al-Wehda for dust

Odion Ighalo score goal against Al-Qadsiah
Share this

Na so former Super Eagles striker, Odion Ighalo, tear net again after 66 days wey e never score, but em fine goal no fit save Al-Wehda as dem still collect 3-1 beating from Al-Qadsiah for Saudi Pro League match wey happen on Thursday night.

Odion Ighalo don finally score after 66 days but na ex-Chelsea baller land him and Al-Wehda for dust

Na Ighalo open the scoring for 29th minute with one correct left-foot banger—and na im first goal against Al-Qadsiah—but as match finish, na Al-Qadsiah still waka comot with three points inside Prince Mohamed bin Fahd Stadium, hitvibz reports.

Odion Ighalo Break Goal Jinx with better Goal Against Al-Qadsiah

E be like say na today grace land for Odion Ighalo head as e use left leg hammer one serious goal go top corner—na em sixth league goal be dat this season.

The goal still mean say e don gather nine goal contributions this season: six goals, two assists for league, and di oda one for King’s Cup.

Ighaloighalo

Before this goal come against Al-Qadsiah, the last time Odion Ighalo kuku manage see back of net na since March 6, when e help Al-Wehda beat Al-Raed 3-1.

Since then, em leg don dry pass harmattan as e don go seven matches without goal, even though e still drop two assists.

But joy no last reach halftime. For 43rd minute, Ezequiél Fernández carry ball give Cameron Puertas, wey scatter one rocket from outside box go top corner. Game don balance 1-1.

Al-Qadsiah Come Deliver Last Minute Heartbreak as Al-Wehda fall inside deep pit

Just as second half star, one former Chelsea baller Pierre-Emerick Aubameyang knock goal for Al-Qadsiah but VAR come cancel am. Al-Wehda think say dem fit hold draw, but wahala still dey come from nowhere.

Odion Ighalo don finally score after 66 days but na ex-Chelsea baller land him and Al-Wehda for dust

Coach commot Odion Ighalo for 66th minute, put Jawad El Yamiq. From dat time, Al-Wehda matter begin bend.

For 86th minute, Puertas score again after one sweet header assist enter am. Four minutes to full time, Al-Wehda don dey look clock, na so another gbege land.

98th minute, dat ex-Chelsea man turn from assist king to goal scorer as e use right leg finish ball from near post.

VAR check am say di goal go stand. Match end 3-1. Al-Wehda lose after don give fans hope when dey bin win Al-Fateh and Al-Okhdood.

Odion Ighalo dey celebrate em goal against Al-Qadsiah

Al-Qadsiah dey third for table now and still dey follow Al-Ittihad drag league title—but dem dey 10 points behind.

Meanwhile, Odion Ighalo and him Al-Wehda people go need carry lion heart enter their last two matches against Al-Hilal and Al-Ettifaq—na win or waka go lower division.

You Like this post abi?
Oya we go like hear from you abeg. Help us drop small comment for the box below!

Be the first to comment on "Odion Ighalo don finally score after 66 days but na ex-Chelsea baller land him and Al-Wehda for dust"

Leave a Reply