Nigerian striker Victor Olatunji don start the new Major League Soccer (MLS) season on a high level, as him score to help Real Salt Lake draw for away inside one heavy match against San Diego FC.
The 26-year-old player come enter from bench to open him goal account for the season for just him second match, as him score late equalizer to save him team from defeat, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Victor Olatunji tear late equaliser wey save Real Salt Lake
Olatunji na the hero of the day for Snapdragon Stadium, as him late goal make the match end 2-2 for Real Salt Lake.
After him enter to replace Sergi Solans for 67 minutes, the Nigerian player use only 18 minutes for pitch to do him magic.
For him first season with the team last year, the Super Eagles prospect score four goals for nine matches.
Olatunji go dey hope to pass that number this time around, and him don start early to show working.
Real Salt Lake (RSL) fight come back to collect 2-2 draw against San Diego FC, and this one don make am four matches now wey nobody beat dem.
Even though RSL control the match with 21 shots and beta chances, dem still settle for one point.
RSL na dem first score just 17 minutes into the game when Sergi Solans use head nod in the cross wey Juan Manuel Sanabria give am.
San Diego answer sharply with equalizer from Marcus Ingvartsen, and dem even carry the lead go 2-1 for 56 minutes through Anders Dreyer.
Olatunji ginger RSL fightback for di MLS match
But for 85 minutes, Victor Olatunji save the day for RSL as him just tap in the ball wey Morgan Guilavogui cross give am.
Referee even pursue San Diego player Christopher McVey comot for 89 minutes after him get second yellow card.
“One point no bad for us for now. We no go there go find draw. We want three points for every game,” the Niaja striker tell the club website after the match.
The two teams go now go break for international matches, and Real Salt Lake go return to action on April 4 when dem go host Sporting Kansas City.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on March 23, 2026 12:17 pm by Hitvibz Media



Stay connected