Victor Olatunji don drop last-minute banger again: E shock Sigma as em fire Sparta Prague to sweet win

Victor Olatunji
Share this

Sparta Prague fans don shout sotay voice don crack as Victor Olatunji drop another last-minute banger wey tear net for Czech Chance Liga match against Sigma Olomouc.

Victor Olatunji don drop last-minute banger again: E shock Sigma as em fire Sparta Prague to sweet win

Just when e be like say match go end draw, na so di Naija striker enter scene, scatter plans, and carry all three points waka comot, Hitvibz reports.

Victor Olatunji last-minute banger burst Sigma Olomouc bubble

From kick-off, Sparta Prague show say dem mean business. Na Jan Kuchta open di scoring for 25th minute after e use sharp reflex tap rebound enter net.

But Sigma Olomouc no gree, as Filip Zorvan use beta footwork waka pass e marker before e fire shot enter bottom corner for 37th minute.

Victor Olatunji don score last minute winner again

Di home team nearly use penalty take nack Sparta Prague yawa for 79th minute after Martin Vitik do foul.

But na demsef go still regret am as Zorvan waste di chance, and Sparta keeper Peter Vindahl show class with one ogbonge save.

Just when everybody don dey reason say match go finish 1-1, Victor Olatunji show face.

Di 25-year-old wey just resume goal-scoring work after 73 days, use one sweet assist waka enter box, then send one clinical low shot enter bottom corner for 87th minute.

VAR wan do wahala, but goal stand. Na so celebration burst!

Sparta Prague ready for title war after Olatunji wahala

Victor Olatunji don drop last-minute banger again: E shock Sigma as em fire Sparta Prague to sweet win

With dis win, Sparta Prague don stretch dem unbeaten run reach six matches and dem still dey eye di league title.

Dem dey second for table, but di next match against Slavia Prague na real gbas-gbos, wey fit decide who go carry di trophy.

With di way Victor Olatunji don dey knack last-minute banger steady, Sparta Prague fans go dey hope say e go still deliver another magic moment for di big derby.

Like this post?
We’d be delighted to hear from you. Please leave a comment in the box below!

Be the first to comment on "Victor Olatunji don drop last-minute banger again: E shock Sigma as em fire Sparta Prague to sweet win"

Leave a Reply