Nathan Tella no dey dull at all! The Super Eagles baller no waste time before he begin show levels for Bundesliga as him net sharp goal wey help Bayer Leverkusen scatter Eintracht Frankfurt 4-1 for dia backyard.
The win no just humble Frankfurt for dia home, e still make Leverkusen extend dia unbeaten away run reach 29 matches, wey be Bundesliga record, Hitvibz reports.
Nathan Tella show em class as Bayer Leverkusen tear Frankfurt apart
Tella start fire for 26th minute as e use better movement take confuse Frankfurt defence.
Granit Xhaka find am with correct pass, and the Naija baller no waste time—e shift ball past Arthur Theate, then knack better shot wey enter bottom-left corner.
Just three minutes later, Leverkusen add another one as Nordi Mukiele take sharp reaction inside box wahala score di second goal.
Xabi Alonso boys no gree rest as Patrik Schick make am 3-0 before halftime, after another sweet buildup wey Xhaka and Alejandro Grimaldo arrange.
Leverkusen no send as unbeaten run stretch dey go Maiduguri
Frankfurt try find hope before first half finish as Hugo Ekitike manage score from one Leverkusen mistake.
E nearly score another one for second half, but e volley jam post.
Any small hope wey remain, Aleix García wipe am comot as e knack one correct volley wey make am 4-1.
By 77th minute, Victor Boniface enter field replace Nathan Tella, as Leverkusen hold body secure di win.
Di result keep dem tight inside title race, still maintain eight points gap behind Bayern Munich.
As for Frankfurt, na back-to-back 4-goal defeat dem don collect, and dia home form don kpai.
Be the first to comment on "Super Eagles baller Nathan Tella don burst net as Leverkusen scatter Frankfurt for Bundesliga"