Our Super Eagles boys, Paul Onuachu and Chibuike Nwaiwu, don show say dem get levels as dem join bodi help Trabzonspor collect better home win against Galatasaray wey lead for Turkish Super Lig table.

Paul Onuachu scoring for Trabzonspor in Super Lig match

Onuachu and Nwaiwu continue dia fire form for the Black Sea Storm after dem return from international break where Nigeria play Iran and Jordan. Dem no waste time at all to find net, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Paul Onuachu and Nwaiwu Shine for Trabzonspor Win

​Onuachu wey be 31-year-old open floor wit first goal, while Nwaiwu nail the match-winner as Trabzonspor beat Victor Osimhen team 2-1 for Papara Park.

  Super Eagles for AFCON 2025: Records, Goals, Opportunity Dem Miss and How Dem Take Win Bronze

​The last time the two of dem score for inside same match na February 28, when dem beat Karagumruk 3-1. That time self, Onuachu score first before Nwaiwu use him own goal seal the win.

​For this round 28 match, Onuachu don reach 26 goal contributions this season—22 goals and two assists for Super Lig, plus two goals for Turkish Cup. Nwaiwu now get three goals and one assist for him pocket.

Chibuike Nwaiwu celebrating winning goal against Galatasaray

​Another Super Eagles star, Anthony Nwakaeme, show him senior man vibez as na him give the assist for Nwaiwu winning goal.

That na him second assist for the season, and e help the home team pack all the three points..

  Paul Onuachu Dey Feel Am: Everything Wey Em Talk as Trabzonspor Begin Season With Fine Win

​Onuachu, Nwaiwu, and Nwakaeme Control the Game

​Onuachu no come play at all, as e use only four minutes score the first goal to give Trabzonspor lead before half-time.

Wagner Pina carry one correct cross come, and Onuachu use him head wire the ball go bottom left corner.

​Three minutes after dem start second half, Galatasaray draw the match. Baris Alper Yilmaz nak one better cross enter box, and Wilfried Singo just finish am with quick shot—the keeper no see road at all.

Anthony Nwakaeme assisting goal for Super Eagles teammates

​Fourteen minutes after that one, Nwakaeme set another cross, Nwaiwu jump up like bird on top the six-yard box come use powerful header wire the ball.

  "I happy say I don enta Scoresheet" - Frank Onyeka don stop Brentford winless run wit em first Premier League goal

​The ball fly enter the top left corner, and na so Trabzonspor take win 2-1, as dem continue to tension the league.
.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on April 4, 2026 9:21 pm by Hitvibz Media