Hull City don suffer serious wahala as Semi Ajayi go dey for sideline for next two months after him hamstring injury for Africa Cup of Nations.

Semi Ajayi injured during Africa Cup of Nations

Na during added time of Nigeria third-place win against Egypt him limp comot, and scan confirm say the injury serious, fit make am miss seven weeks, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Semi Ajayi Injury Na Big Blow for Hull City

Dis one na another gbege for Hull City, wey don already dey deal with long-term injury for Mo Belloumi and Darko Gyabi.

  Samuel Chukwueze Don Enter Fulham January Goal of di Month Race

The Tigers dey try manage without their key defenders as dem dey fight keep promotion hope alive for Championship.

Even with dis wahala, Hull City show say dem fit handle am, dem carry 3-0 win come road against Preston North End.

Hull City celebrate victory without Semi Ajayi

Goals wey Liam Millar, Akin Famewo, and Oli McBurnie score make sure say team no lose momentum even without Ajayi for back.

Jakirovic Squad Show Say Dem Fit Manage Injury Crisis

Another naija boy Babajide David even comot for the game because of cramp, but dem dey hope say em go ready for weekend match.

  Umar Sadiq break 10-month La Liga dry spell, drop cobra celebration as Valencia win

Sergej Jakirovic managing Hull City without Semi Ajayi

Semi Ajayi injury go test Hull City well-well as dem dey try remain for promotion fight.

Remember say for AFCON tournament, Ajayi carry Player of the Match trophy after e knack goals and show better play against Tanzania for group stage.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on January 21, 2026 12:12 pm by Hitvibz Media