Di Super Eagles Derby for Premier League don hapun as Ola Aina, Alex Iwobi, and Calvin Bassey play full 90 minutes for that tight 0-0 draw between Nottingham Forest and Fulham for City Ground.

Calvin Bassey in Super Eagles Derby

Even though goal no enter, our Super Eagles boys na dem be the heart of the drama throughout the match, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Super Eagles Stars Data Breakdown: Defensive Level and Near Misses

Ola Aina: He nak the crossbar with one 20-yard rocket and he still block one ball wey for be goal. (Him 13th game this season). 0 Goals, 1 Assist so far.

  Wilfred Ndidi Give Assist as Super Eagles Star Help Beşiktaş Win Europa League Match

Calvin Bassey: He almost win the match for Fulham with one header wey for enter net (if no be Sels save).

1 Goal, 0 Assists. He too set for back with 9 clean sheets across all competitions.

Taiwo Awoniyi in Super Eagles Derby

Alex Iwobi: He play full 90 mins, dey control things for midfield.

4 Goals, 3 Assists. Na him be the creative heartbeat; 1,964 minutes of pure engine work.

  Calvin Bassey: Why Fulham coach Silva dey bench Super Eagles star after AFCON return

The Impact: Taiwo Awoniyi & Samuel Chukwueze Enter to Give Dem Fire (62’/63′)

Awoniyi: 1 Goal, 0 Assists. He still dey fight to reach 100% fitness; he almost score the winner for 88th minute.

Chukwueze: 3 Goals, 4 Assists. He be pure wahala as he enter from bench today with total 7 goal involvements this season.

Ola Aina in Super Eagles Derby

This point big well-well as e carry Forest commot for relegation zone sake of goal difference.

  Nathan Tella Still Dey Hot as Boniface, Durosinmi Play for Leverkusen Win Against Genk

You feel say Aina na the best Nigerian fullback for Europe right now?

Last Updated on March 16, 2026 10:25 am by Hitvibz Media