Nigeria vs DR Congo Match: Everything Wey You Suppose Know Before Di Kick-Off

Nigeria vs DR Congo final match at Stade Prince Moulay Abdellah

Omo, Nigeria vs DR Congo match, na the next big wahala wey dey come this Sunday as Super Eagles go meet DR Congo for the CAF World Cup final play-off wey go happen for Rabat.

Super Eagles in training

Anybody wey manage win this one go move go the March FIFA Inter-Continental Play-Off, and na dem go still dey hold Africa flag high for 2026 World Cup, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Semi-Final Drama Don Set the Mood for Nigeria vs DR Congo Game

Eagles no carry last, dem hammer Gabon 4-1 after extra time. Akor Adams show say him no dey joke as him open scoring, but Mario Lemina come balance am for 89th minute, so na extra time we go enter.

Then Chidera Ejuke knack goal just 7 minutes into extra time, and Victor Osimhen come run am clean with two bangers, make Nigeria waka go final despite all the gbege for camp — pay wahala, training boycott, wahala full ground!

Super Eagles star Alex Iwobi

Meanwhile, DR Congo no dey carry last too. Dem shock Cameroon 1-0 for stoppage time with Chancel Mbemba header from corner. Wahala dey o, but dem still reach final.

  Ademola Lookman fire again, drag Atalanta commot from bad run with one clean finish

Na Sebastien Desabre dey coach dem. Dem wan see their second World Cup, as last time dem play na 1974.

Final go dey Stade Prince Moulay Abdellah, Rabat, Morocco. Kick-off na 7:00 PM GMT (8 PM Naija time). You fit watch am for SuperSport, StarTimes, Sporty TV, or stream live FIFA+.

Nigeria vs DR Congo: Team News & Wahala Dem

Wilfred Ndidi go miss this one cos him yellow card package full. Omo, that one na heavy blow for Eric Chelle side.

Now Frank Onyeka go fill him place for midfield, Raphael Onyedika go dey backup.

  Emmanuel Fernandez Carry Rangers W, Godwin Show Say Him Dey on Fire for UAE

Nigeria vs DR Congo team lineup and tactical preview

But gbam, Onyeka, Osimhen, Alex Iwobi, Bright Osayi-Samuel and Stanley Nwabali dey one booking away from missing the inter-confederation if Naija waka pass. E no easy!

DR Congo come waka enter final clean, only Mbemba get caution.

Dem Leopards go try use tight defence block Eagles, but Naija firepower dey serious — Osimhen, Adams, Lookman fit kpai everybody for pitch if dem dey on form.

Nigeria vs DR Congo: Tactics & Gist for Sunday

Naija get better attack, DR Congo get tight defence wey fit stress Eagles.

Eagles go dey exploit wing spaces and Osimhen for box go be headache for Leopards defence.

Super Eagles vs Gabon

History Don Show Small Clues

Dis one na first competitive meeting since 1-1 friendly draw in 2018.

Past games:

Naija don win two times

DR Congo don win three times

Draw happen once

  Victor Osimhen shine kpakpa as Onyedika, Oshoala and other Naija ballers try dia best for abroad

Prediction? Omo, we dey see Naija 3-1 DR Congo. Expect wahala, better fight, quarrel, individual skill, tactical battle — pure package.

Sunday go sweet d!e! History dey balanced, stakes high, but one thing sure — whoever win go dey one step closer to 2026 FIFA World Cup.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on November 15, 2025 3:25 am by Hitvibz Media

About the Author

Hitvibz Media
An educationist, who loves good music and Football. A creative writer, footballer and content editor.

Be the first to comment on "Nigeria vs DR Congo Match: Everything Wey You Suppose Know Before Di Kick-Off"

Leave a Reply