Super Eagles star man, Moses Simon, don finally carve him name for French football history.

Moses Simon and Paris FC teammates line up vs Strasbourg

He just play him 200th Ligue 1 match inside that tight 0-0 draw wey Paris FC nak against Strasbourg, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Moses Simon: From Nantes Legend to Paris FC Engine: E No Dey Tire

Simon consistency no be here. After 6 years of show for Nantes—where he drop 70 goal involvement (33 goals and 37 assists) inside 177 games—he don carry that same fire go become the engine room for Paris FC.

  Tolu Arokodare don tear net 16 times for Genk – Super Eagles coach go dey see am for dream every night

The Simon File (2025/26):

Total Games: 23 (3 Goals / 2 Assists)

Work Rate: 94% pass completion for today match.

Level: He be the 4th Nigerian for history to reach 200 games for France.

Moses Simon in action for Paris FC vs Strasbourg

Paris FC dey 13th position for table now, but as milestone man Simon dey lead the team against Le Havre next, you think say dem fit enter Top 10?

  Terem Moffi don drop strong message with him first goal as FC Porto hammer Arouca

Drop “🦅” make we celebrate our Super Eagle!

Last Updated on March 16, 2026 10:16 am by Hitvibz Media