Sevilla preseason waka get correct ginger Monday night as Naija ballers Kelechi Iheanacho and Akor Adams carry their first trophy with the Spanish club.

Kelechi Iheanacho dey celebrate Antonio Puerta Trophy with Sevilla

Even though na just friendly, that Antonio Puerta Trophy na big sign say better don start for the two boys wey don already dey blend well inside Sevilla jersey, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Fast Start: Akor Adams Show Himself From Kick-Off

Adams start the match for Estadio Ramón Sánchez Pizjuán, as e bring gidi energy and muscle enter di La Liga team attack.

The former Montpellier striker no waste time at all – e fire sharp right-footed shot wey make Al Qadsiah defence panic and force corner.

Nigerian ballers Kelechi Iheanacho and Akor Adams at Sevilla trophy win

Few minutes later, e thief ball from defender, blast another heavy shot wey goalkeeper Koen Casteels manage block.

  Kelechi Iheanacho don ready to ball again for Sevilla, dey hope for fresh start after plenty wahala

Adams play reach 83 minutes before coach sub am for Pablo Rivera. Him whole performance show say he fit be serious wahala for defenders this season under coach Matías Almeyda.

Kelechi Iheanacho Enter From Bench, Add Sauce Make Dem Win

Dem bring Iheanacho enter 66th minute to replace Djibril Sow, and e come add better swagger and calmness for front.

Him movement and link-up play scatter Saudi defence small, even though di Spanish team still collect 95th-minute equaliser wey carry match go penalty shootout.

  Stephen Alfred Fire Big Goal Wey Carry Torpedo Go Next Round for Europe

Sevilla’s Kelechi Iheanacho & Akor Adams pose with preseason title

As match finish 2-2 for full-time, wahala move go penalty level. Na Sevilla keeper Nyland be the boss – e save two penalty shots.

Pedrosa, Manu Bueno, Peque and Castrín score their own kicks sharp-sharp, come use am seal the win – Antonio Puerta Trophy remain for Nervión.

After the game, everywhere burst – Iheanacho and Akor Adams dey jubilate like old pros, chop their first glory for Spain like say na normal.

Akor Adams dey in action during Sevilla preseason match

Even though na preseason title, Iheanacho and Adams don already show say dem ready to shine for La Liga this season.

  Akor Adams don talk wetin go sweet am every week after him winning goal against Atletico Madrid
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 5, 2025 11:15 pm by Hitvibz Media