Naija striker Akor Adams no waste time to drop him La Liga “I don land” card. Baba knack him first goal contribution for Sevilla opener.
But las las, e no save the team. Sevilla still chop 3–2 loss for Athletic Club backyard, San Mamés wey dey hot like pepper soup Sunday evening, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Akor Adams Ginger No Fit Save Sevilla
Akor no come Spain to play ludo. Guy man put hand for Sevilla comeback, na him give the pass wey Lucien Agoume use balance score 2–2.
Hope don full body, everybody think say comeback movie don start. But omo, Athletic no gree. Dem run am back with late goal, Sevilla pocket L carry go house.
E still sweet reach say another Naija boy, Chidera Ejuke, enter second half. Him replace Stanis Idumbo Muzambo when Sevilla don already dey trail 2–0.
Ejuke try ginger, but matter don already bend like VAR camera angle.
Athletic Start Fire, Sevilla Try Quench
Match open, na Athletic chop first meat. 36 minutes, Nico Williams do penalty like prime Drogba, boom 1–0.
Just seven minutes later, Maroan Sannadi add another one, make am 2–0. Sevilla defenders dey look like spectators wey no pay gate fee.
But Sevilla vex after break. Dodi Lukebakio reduce am 2–1 after Juanlu Sánchez help am serve hot ball. Few minutes later, Akor turn waiter, dish sweet assist for Agoume, 2–2, hope don full stadium.
But na lie, Nico Williams vex again, turn provider this time, feed Robert Navarro for 81st minute. Athletic seal 3–2 like person wey lock fridge with padlock. Game over.
Naija Derby Loading: Akor vs Uche
Even though Sevilla lose, make we no lie, Akor Adams show say he get fire for boot. Na him debut, but guy don drop assist. If na FIFA card, him “contribution” don already upgrade.
Next stop? Sevilla go face Getafe. And na there we go get Naija vs Naija – Akor Adams vs Christantus Uche, the same Uche wey just scatter Celta Vigo with one goal, one assist.
Naija boys dey turn La Liga to Super Eagles training ground. Abeg, who go shine pass for this derby?
Akor wey dey hungry for goals or Uche wey dey play like Yaya Touré wey sabi chop pepper soup?
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 18, 2025 7:01 am by Hitvibz Media



Stay connected