Super Eagles man, Ademola Lookman don finally tell Atalanta say him wan comot, afta plenty months wey wahala dey go on lowkey for back.

Ademola Lookman don Drop the Mic: “I dob Give Everything to Atalanta

Di Naija baller wey shine last season for UEFA Europa League, say him no fit dey chop “empty promises” again plus wetin e call “bad belle treatment” from di oga people wey dey run di club, na weytin hitvibz dey yan be dat.

“E Don Do!”: Lookman Say Atalanta Don Run Am Street

As e delete every Atalanta mata comot for him Instagram, Lookman drop one emotional statement wey show say him mind don full.

Him clear say him wan comot — and e prefer make Inter Milan carry am.

For di touching message wey e drop, Lookman no even hide mouth:

Ademola Lookman don react after handing in transfer request to Atalanta

For the past three years wey I dey Atalanta, I don give dem everything… But now wey offer show wey dey make sense based on wetin dem promise me before, dem wan block am for reasons wey I no even sabi.”

Di 26-year-old talk say even when other clubs bin dey show interest, him still stay loyal cos him believe say Atalanta get plan. But now, him say him eye don clear.

  Stephen Alfred Fire Big Goal Wey Carry Torpedo Go Next Round for Europe

From Europa League Shine to Gbas Gbos for Back

Lookman journey for Atalanta no be small.

Di guy don become fans padi because of him dribble levels, work rate and important goals — especially dat night for Dublin wey dem carry their first ever European cup.

Ademola Lookman Don Vex for Atalanta, Drop Mic, Ask Make Dem Let Am Waka

But all di smile wey we dey see for pitch no tell us wetin dey really happen for back. According to Lookman, na plenty things him don dey keep coded since.

  Jennifer Echegini don score 5th goal dis season as Juventus and Inter Milan nack draw gidigba

Di final straw? Dem no gree let am go even when Inter drop correct offer.

Message to Di Fans: “This Place Be Like Home to Me”

Even though kasala don bust, Lookman still drop heartfelt message for di Atalanta fans:

To di fans — una be di soul of this club — I dey really sorry say e reach like this… Una support mean everything to me.”

Him still talk say him dey pray make dem settle di mata in peace, but e don clear say him leg wan waka go.

Inter Milan Dey Reason Am Sharp Sharp

🐦

Now wey Lookman don yan him mind, Inter Milan no dey dull — dem don begin move sharp to sign di winger before transfer window close.

  Kelechi Iheanacho don nack fresh injury wahala wey shock Celtic fans for Europa

For club wey dey find person wey fit ginger attack, Lookman pace, experience, and eye for goal fit just be di correct plug.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 3, 2025 2:26 pm by Hitvibz Media