Man wey dey hot right now, Cyriel Dessers, don continue from where e stop last season, as e nack one goal come still drop assist wey ginger him team Rangers make dem knack Viktoria Plzeň wella for Champions League qualification round 3 wey happen Tuesday evening.

Cyriel Dessers na em assist Djeidi Gassama for Rangers' opening goal

Na the Super Eagles baller open the scoring plus come add another goal as Gers wash their visitors for the first leg of the game wey shele for Ibrox Stadium, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Cyriel Dessers Dey Lead di UCL Jollof With Goal and Assist

Even though na Dessers carry the shine, him fellow Naija guy Rafiu Durosinmi no even smell goal and dem just lock am like phone wey no get battery.

Dem later commot am for 65th minute, na Prince Adu come enter in place.

Cyriel Dessers scores penalty, do assist

The goals just dey rush early for the Scottish side as Dessers collect ball from Djeidi Gassama for edge of box, come chook better pass wey cut through defenders give Gassama to just tap am inside net make em team lead.

  Rafiu Durosinmi Land Last Blow as Viktoria Plzen Shock Servette for Switzerland

Djeidi Gassama wey fans dey feel now now don score three goals for three back-to-back European matches.

Na that him goal give di Gers early edge come set correct tone for the night wey dem dominate.

Rangers Scatter Plzeň As Dessers Dey Shine Like Touch

Just as half-time wan land, Oliver Antman run anyhow wey make dem blow penalty for di Scottish team.

And who go play am if no be our Naija goal machine?

Dessers wey knack 29 goals plus six assists last season, just waka go penalty spot, push the ball enter one side, keeper dive another side — 2-0 sharp sharp for Rangers.

  Emmanuel Fernandez Carry Rangers W, Godwin Show Say Him Dey on Fire for UAE

Rangers players na dem dominate Viktoria Plzeň in Champions League clash

Plzeň own don finish early for second half. Gassama come score again for 50th minute after correct team work.

Na Max Aarons send ball go back of Plzeň defence, Oliver Antman just burst run for right wing like say e get flight, deliver one better cross.

Gassama jump meet am with one correct header wey keeper no fit do anything.

After the guy don finish him assignment wella, Dessers come rest as Danilo replace am make e fresh.

Score no change again, match finish 3-0 for house of Rangers.

  Super Eagles Legend Victor Moses Don Land FC Kaysar, Carry Premier League Experience Join

Dem go jam again next week Tuesday by 6:00 p.m. If Rangers win or even draw, Dessers and him guys go enter Champions League.

But if Plzeň no do miracle, na Europa League dem go enter.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 5, 2025 11:14 pm by Hitvibz Media