Ademola Lookman: Atalanta presido don pour cold water for Gasperini ’emotional’ mouth after penalty wahala

Ademola Lookman, Atalanta presido
Share this

The way Atalanta take waka comot for Champions League no sweet dem at all, but na wetin happen after di match with Ademola Lookman dey burst brain pass.

Ademola Lookman recieve backing from Atalanta presido

E be like say the Super Eagles baller, and ‘im coach, Gian Piero Gasperini, no too gel again after wetin Gasp talk, Footballrover reports.

Atalanta presido, Stephen Gerard Pagliuca, no waste time as e jump inside the matter to arrange things.

Atalanta Presido no like how Gasperini take open mouth waaah drag Lookman

The whole gbas-gbos start after Atalanta chop 3-1 for Club Brugge hand wey make dem waka comot for Champions League.

During the match, Ademola Lookman miss one ogbonge penalty, and Gasperini no even kuku get chill—e call Lookman “one of the worst penalty takers” wey e don see.

Ademola Lookman: Atalanta presido don pour cold water for Gasperini 'emotional' mouth after penalty wahala

The tin come pain my guy, but na fans di matter vex pass! E be like say Gasperini mouth too sharp, and the thing cause serious wahala.

Pipo begin drag am left and right like okrika cloth, say how coach go throw ‘im own player under bus like that? No be even better bus, Ajegunle molue.

Na so Atalanta presido, Pagliuca, enter the matter to cool things down.

As e yarn for Gazzetta dello Sport, Pagliuca talk say Atalanta no be club wey dey blame players anyhow. E talk say Gasperini just too dey emotional and ‘im reaction no follow Atalanta way at all.

But even as e correct Gasperini, e still stand by am, call am great coach wey get passion.

E no suppose talk like that about just one person because for Atalanta, our way na say if wahala show, we go take blame, check wetin we fit do better,” na wetin Pagliuca yarn as Sportmediaset quote am.na wetin Pagliuca yarn as Sportmediaset quote am.

Gasperini just too carry emotion, e talk wetin e no suppose talk, and e no follow our way at all. We no proud of am. But make I talk again—Gasp still be correct coach,” e add.

Ademola Lookman no send, E fire back with two goals!

Instead make Lookman let the dragging affect am, baba vex enter pitch for Atalanta next Serie A match against Empoli.

No be small thing—Lookman para well, score two clean goals as dem knack Empoli 5-0. E come be like make Gasperini dey curse am every time sef. Person wey just dey come back from injury oh!

Ademola Lookman: Atalanta presido don pour cold water for Gasperini 'emotional' mouth after penalty wahala

Pagliuca sef use the win take show say the club don move on from the wahala. E even hail Lookman and Charles De Ketelaere, talk say na teamwork dey make Atalanta strong.

Even though Gasperini talk put fire for the matter, Atalanta no let am scatter their focus.

Dem still dey hustle for Serie A, and dem dey only three points behind Inter Milan. The wahala fit don cool, but e sure say Lookman no go forget am anytime soon.

Like this post?
We’d be delighted to hear from you. Please leave a comment in the box below!

Be the first to comment on "Ademola Lookman: Atalanta presido don pour cold water for Gasperini ’emotional’ mouth after penalty wahala"

Leave a Reply