Wetin sup dey for Enyimba? Bernard Ovoke just shock everybody dis afternoon as e comot from Enyimba just one year after e sign for dem.

Bernard Ovoke at Enyimba

Nobody sabi wetin really happen, but na by mutual agreement dem take end di contract. Now, e don waka, and fans dey wonder why di matter be like this, Hitvibz reports.

Bernard Ovoke comot from Enyimba after just one year

Di 27-year-old winger land for Enyimba on February 15, 2024, but e no last reach two seasons before e decide say e don do.

Bernard Ovoke don vex pack em kaya japa—Enyimba badge no dey sweet am to kiss again

After just 12 months and 17 days, di guy don pack hin load, comot from di Aba-based club. No be say e get wahala with di club, but di way e waka quick don make fans dey ask questions.

Even as e comot, Ovoke still show respect to Enyimba. E talk say e appreciate di opportunity to play for di People’s Elephant and hail di management plus hin teammates for di support wey dem give am.

  Rivers United end five-month NPFL juju as dem bounce back beat Wikki Tourists to keep title hope alive

“I dey grateful say I play for Enyimba FC. Di season make sense well, and e sweet me to be part of di People’s Elephant. Big thanks to di management and my teammates for di journey,” na so em yarn am for X platform.

Bernard Ovoke comot from Enyimba—wetin be em next move?

Ovoke career don carry that em leg waka for plenty clubs sha. E start for Bayelsa United before e go Rivers United for 2016.

  NPFL Matchday 21: Rivers United Hold Remo Stars for Neck, Abia Warriors Dey Make Title Matter Hot

In 2019, e move go Plateau United, then e try hin luck for Armenia with FC Sevan for 2021.

That one no do am, e turn to free agent for 2022 before Rivers United collect am back for March di same year.

Bernard Ovoke don vex pack em kaya japa—Enyimba badge no dey sweet am to kiss again

After dat, e still run comot, come go play for Lobi Stars (September 2022) and Kwara United (July 2023) before em finally land for Aba, where em go buy boot oh!

Enyimba sight am, kuku rush go sign am last February.

Everybody think say e go settle well under Stanley Eguma, but na lie, di matter don turn another tin.

Now, e don dey market again as free agent, and we go soon see where e go land next.

  Lobi Stars don enter one chance—87 days no win, but coach say 'we still dey build, we go fix am'

Na so di football life be—e fit switch at any time, e be like NEPA!

Like this post?
We’d be delighted to hear from you. Please leave a comment in the box below!

Last Updated on February 26, 2025 8:02 pm by Hitvibz Media