Nigeria Premier Football League (NPFL) Matchday 22 bring correct gbege come again, as shock results, late goals and big wins scatter both top and bottom of table.
From Enugu reach Minna, big teams waka anyhow, teams wey dey fight relegation show pepper, and title race tight well well as Rivers United siddon sideline dey watch, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Wetin Happen for NPFL Matchday 22
For Enugu, Rangers International forget all off-field wahala come deliver serious football, beat Warri Wolves 4–2 for Nnamdi Azikiwe Stadium.
Godwin Obaje and Chimobi Igwilo score two-two goals each, carry Flying Antelopes enter top-four conversation with hot first-half display.
For Bauchi, Wikki Tourists add more sorrow to Kano Pillars relegation matter as dem win dem 2–0 clean.
Goals from Taheer Abubakar and Klinshak Longbak push Wikki comot danger zone small, while Pillars still dey soak for relegation mud.
For Minna, Niger Tornadoes give Enyimba better football lesson, beat dem 2–0 without stress.
Abdulrasheed Shehu Dabai open scoring, before Rickson Mendos kill match late, add more wahala to People’s Elephant shaky season.
For Ibadan, Shooting Stars stop Bendel Insurance unbeaten run. Qamar Adegoke fire thunder shot for 71st minute take give 3SC important 1–0 win.
For Umuahia, Nasarawa United shock Abia Warriors with strong 2–1 comeback.
After dem concede before halftime, goals from Habibu Alakija and Jofrank Istifanus turn match upside down and move Solid Miners closer to top.
For Maiduguri, El-Kanemi Warriors wait till last minute do magic as Muktar Ismail score for 89th minute seal dramatic 1–0 win against Ikorodu City.
Barau FC and Bayelsa United share points for tight 1–1 draw, while Katsina United and Plateau United play boring 0–0 for relegation six-pointer.
NPFL defending champions Remo Stars still dey struggle as bottom team Kun Khalifat hold dem 1–1, drop more points for dem survival fight.
Match between Kwara United and Rivers United no hold because Rivers United get CAF Champions League duty.
NPFL Matchday 22 Results Sharp Sharp
Enugu Rangers 4–2 Warri Wolves
Wikki Tourists 2–0 Kano Pillars
Niger Tornadoes 2–0 Enyimba
Shooting Stars 1–0 Bendel Insurance
Abia Warriors 1–2 Nasarawa United
Barau FC 1–1 Bayelsa United
El-Kanemi Warriors 1–0 Ikorodu City
Katsina United 0–0 Plateau United
Remo Stars 1–1 Kun Khalifat
Kwara United vs Rivers United (Postponed)
Standings: Top Position Still Tight After NPFL Matchday 22
Standings: Relegation Wahala Still Hot After NPFL Matchday 22
Wetin Next After NPFL Matchday 22
As Rivers United dey continue CAF Champions League journey, focus don shift go Matchday 23.
Nasarawa United go host Enyimba for big top-half clash. Abia Warriors go welcome Wikki Tourists, while Rangers International go travel go face Plateau United.
Down for table bottom, survival fight go hot as Kun Khalifat face Kwara United, while Kano Pillars go host Katsina United for must-win match.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on January 27, 2026 7:35 am by Hitvibz Media









Stay connected